
Sign up to save your podcasts
Or


So wetin or which of dem foods wey we dey refer to as African foods? Why bi say after dem don mindfuck you finish come give you certain unhealthy products, you come begin dey call and lebel dem "AFRICAN FOODS" wetin concern Africans, concern cow body? Abeg Listen below..
Toxic! Why Are You Slowly Killing Yourself? She you sabi say dem things wey you dey apply to your body dey slowly damage and will eventually kill you abi?
I wan tell una wetin i honestly feel about that my beloveth Country Naija, the things wey i bin witnessed and observed the time wey i go Naija, as much as that Country hard reach, Naija still dey hold dem face up and smile at every situation wey dem find themselves in... abeg listen and if you get comment, drop am below, nothing do u.
Naija vacation 2022 / Wetin happen in Nigeria
My people its about that time again wey be say man pikin gp begin dey yarn on some of dem tins wey man pikin bin see for Naija, Nigeria na hard place, a sweet and wonderful place to be at for people wey get money, e get wetin i observe while i was in Naija, Nigerians are using Dollar disguise as Naira, dem dey pay for tings in thousand.
Nigerians and their drama lol!
Nigerians don dey yelled about corruption and bad Governance for years abi? Time don reach now to see how serious we are to changing Nigeria for the better. wetin you are about to hear so na my opinion and how I take see am.
DARKYDEY RADIO
We are excited to Annonce the commencement of Darkydey Web Radio starting January 1st 2023 on www.darkydey.com hosting on Krachouse Network, You can now listen to live podcast session and old-school / New-school Nigerian and African music, Talk shows with guest and call in sessions.
Staying True To Who And What You Represent, Na Today? Una sabi dat case don tay!!!! What is tradition and how does it define 🤔 a people? @tradition @people @darkydey
According to google ( no bi me-oo) to mould person or something means .- to change or influence them over a period of time so that they develop in a particular way, una see am?
Naijs people in Nigeria wahala don reach levels wey be say i really can't stand these ignorant fools anymore, because you live in the diaspora everyone wants to live off you. it's so annoying and sickening 😒 am @darkydey and this is @ChurchofWisdom @podcast
So the year don dey mature small small abi? how far naw? you still dey uphold the pledge wey you bin made on the 31 of Dec 2021 abi you don dey go back to being your old self? you sabi say I no dey here to judge but how far naww? anyway sha, no bi force sha! if i know say I no dey easy so if you no fit discipline yourself, no wahala.
The title don say am all so I no need to stress myself to tell you say, if oga God don better your pocket this year or in the past and don keep you alive to see the end of this year, make you try reciprocate the love by giving small something back to the pipo wey no bin get your luck dis year, so listen and pay attention:-
Una sabi say na dis period of the year na im pipo dey go crazy pass bicos everibodi wan hurry hurry make enuf moni wey im go fit cary go home to go see and reunite with pipo for Village, and na dat period of the year too wey pipo dey like to dey make unnecessary mistakes bicos of one ting or the other, na im make I say make I record dis few words of advice to everibodi wey dey listen or wey wan listen, bicos una dey talk say "A word is enuff for dem wise" so listen-: