
Sign up to save your podcasts
Or


2face and Annie Idibia drama, I know say e no concern me but...2face Na Naija icon so, e concern me now!
If you no fit handle your family wahala for house and within your hold, if you come begin dey broadcast am for social media, e mean say u wan make everybodi put mouth for una wahala, and when it concerns people wey bi our national iconic figures, Church of wisdom go follow put mouth. Listen to wetin I get to say on the issue below...
If it does not grow in your ancestral homeland, don`t eat it.
How people go just die like dat after dem don wag Suya and drank fruit juice? I don yarn about all dis things wey dey happen everyday and I don also yarn about things wey we as people no suppose do at all, no do anything bicos you don see another person do am, i don warn una on the things wey una no suppose chop as Africans.
Wetin be "Preventable death"? preventable deaths na that kind dead wey bi say you fit prevent dem from coming to past, for instance, why smoke when u sabi say smoking fit damage your lungs.
What's wahala and yawa and wetin causes stress?
Una sabi say e get people wey bi say, na in their nature to dey cause yawa anywhere dem go, some people just dey wey bi say their own na to carry wahala with dem dey go anywhere dem wan go, no bi say dem dey intentionally cause yawa or wahala but e just bi say, their own version of "Bad luck" na Wahala and Yawa. Na im make I come record dis Podcast say make we take am yarn small, as in discuss wetin be Wahala and Yawa. You know!
Let's talk about the Politic in Nigeria, like I`ve said in my previous recordings that in Church of Wisdom we only preach Knowledge and positivity, we do not talk about or encourage prosperity or materialism, we give advice to whom advise is concern, YOU KNOW! lol. Most ignorance people will go online and start talking and trashing our beloved Rtd Major General Buhari, they keep blaming everything on Mr President
I don yarn about dis matter before but people bin get case with am so I say make I come back come clear the air on this wahala, I don yarn say people suppose chop things wey dey native to the place wey dem bin born bicos your body and the place where you bin born, get connection with eachother.......
If una don watch dat movie una go sabi wetin I mean, una know say for Africa we dey like to do huge party when person die, we go cook food chop am well well for dead person burial ceremony. The boondocks even talked about dis wahala wey I wan yarn about here....
Do I need to really yarn about dis matter? Wetin Google get to say about Cassava and Cynaide?
Cassava, an edible tuberous root often made into flour, contains cyanogenic glycosides, which can result in fatal cyanide poisoning if not properly detoxified by soaking, drying, and scraping before being consumed. Acute cassava-associated cyanide poisoning outbreaks are rarely described.
African heads of states travelling to the west in search medical assistance? Una know say, that na em dey make wanna cry out very loud, wetin be dey bi that thing wey dey worry us? wetin be that devil name wey dey kolo us? I need not write much because I don already yarn am for the podcast below...
These Foods Are Nutritious To Some People But Harmful To Others, some food like broccoli, Potatoes and garlic are healthy to some certain people but very dangerous to others, why is that? why would an African be given the same dose of drug like a Caucasian? If we evolved under different conditions, shouldn't our internal working mechanism also be different? #broccolifood @africanfoodlist #bestafricanfood.