Mai pipu abeg bia make I follow you yan sumtin. Dis wan na beta tok, make e no be say I no follow una tok am before. Una see wetin dey happen for streetz? Una see d kain gbege wey de hapun for dis kawntry? My brother, see as efritin hard like tortoise back... To eat na wahala whereas Jah don tok say na him be d living bread.dis wan go feed person for spiritual realm e go still carry food come meet you for physical realm. Ahan una never read John 6:51?, As I dey tok go, say you want wear better clothes na wahala- oga Jah tok again say if him dey cloth grass o wetin com happen wey you no go wear beta? You don read Matthew 6:28-30? Shooo you don dey play ooo, chai person won go from one place to the other, transport fare go make you think am 10 times b4 you go decide eeeeeiii I sure say you no sabi Elijah level Omoooooo I sure say you don hiss 50 times today, na frustration dey make you hiss naw.
Government fit dey do their own make you dey live soft life nah, na God go run am for you. You no fit suffer like odas bcoz you go get assurance say baba God don make am soft for u. You think say I dey lie you? Dey play... Carry ya bible, if you no get bible carry google, oya check John 16:33
This hard life no Taya you? Make I yan you one truth today, all this one wey dey happen na smallz o.. omo Yoruba go call am "binti" dat wan min say na small hardship be dis.
E get one event wey go hapun wan day soon, e no tey again. The world saviour, the persin wey we dey call JESUS go come from heaven, him angels go follow come. You know wetin dem go dey do? Dem go carry people wey be say dem believe in Jesus, dem liv holy life bifor dem com from heaven. All dis category of people so, Jesus go carry them comot. E go come remain people wey be say them live rough life, fornication today, stealing tomorrow, people wey dey kill person, people wey dey lie... Na these category of people go remain. Oya check Matthew 13:49. You still dey play?
D tori don dey long, wetin I wan tok be say e go pay you make you kon accept Jesus before e go too late.
I dey ring am for your ear naw, rapture go real o. E go happen all of a sudden. Baba go com carry him pikin, people wey no believe am go remain na those ones go face d real HARDSHIP.
No use your salvation play, I say no postpone am.
Jesus dey call you my brother
Jesus dey call you my sister
Jesus dey call you my friend
Pick up the call make him make am soft for you.
Muse: Healing Room (R&M), 02/02/2023
Source: Holy Spirit