Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.
August 20, 2023Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God put hin hand for de eleshion mata make de jorge dem for tork true and make peace dey hawa kontree.De message of Hope dey tell us say wen we know de resin wen make God make we, we go fit get de kain fait wen God want make we get....more29minPlay
August 19, 2023Praise - God word wen we dey take growToday fess song say make Jesus waka for hawa front and de sekond song say God go finish de beta work wen e dey do for yor life.De message of Hope dey tell us say God want make we bi like Jesus so dat pipo go dey see Jesus for hawa life....more29minPlay
August 18, 2023Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen get strong fait to take hold God make God for do watin e want for am na woman wen go bi happi womanDe message of Hope dey tell us say na sin naim bring all dey wahala wen we get today and Jesus with hin sorri-hat con commot sin for hawa life....more29minPlay
August 17, 2023Family matter - God word wen we dey take growDe kweshion of watin we go do wen de stori wen we dey hear abat hawa husband or wife na tru naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na only Jesus go fit save us and give us de kain peace wen go make us rest koole....more29minPlay
August 16, 2023Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growWatin we go do for pesin wen get sikness wen bi like epilepsy bifor we go fit take de pesin go hospita naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say Jesus come die so dat we go fit bi God pikin, make we sef resembo Jesus for dis good work....more29minPlay
August 15, 2023Pikin dem mata - God word wen we dey take growGod don tesh us say rest good for hawa bodi so make we dey plan rest for hinside watin we dey do make hawa bodi for well.De message of Hope dey tell us say Jesus naim God send make e come tesh us abat God make we for know God well well....more29minPlay
August 14, 2023Family matter - God word wen we dey take growWho bi beta mama wen we fit call mama? Watin mama go do wen go make us fit say na beta mama? Na dat bi hawa mata today.De message of Hope dey tell us say Jesus and hin papa no dey kwarel, dem bi one and God want make we sef bi one for church....more29minPlay
August 13, 2023Praya - God word wen we dey take growToday praya na for Niger kontree bicos soja don korlet dey kontree from de pipo wen dey rule am and wahala dey dere now.De message of Hope dey tell us say God way no bi hawa way and to forlow God waka we musto forlow hin way....more29minPlay
August 12, 2023Praise - God word wen we dey take growToday two song na "The LightHouse" and "Shine Jesus Shine" and de song dem dey tell us say make we let pipo see Jesus for hawa life.De message of Hope say if we tru-tru forlow Jesus, dey do watin e tork, hawa life go change and we go resembo Jesus...more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.