
Sign up to save your podcasts
Or


make una hear the latest tori wey dey happen for the awa coubtry Nigeria and Obodo Oyinbo.
Catch the latest tori ontop awa correctfm today. Ogbonge news ontop the things wey dey happen during the corona period.
Shan George talk about her journey in life, how she start and where she dey today. Nollywood actress Shan George talk about how she take dey live her life as an actress
Enjoy all the things wey dey happen for the sport world on top Sport Correct today
For dis episode of Correct Woman, di torchlight na on top everything about Coronavirus and How coro coro as we call am dey affect di African Woman with Eva D Diva and Ona. 'CORRECT WOMAN' only on top CorrectFM as doctor join dem to talk di Covid19 mata well.
Let us know wetin you think. Drop comment and subscribe abeg. Well done!
Many pipol dey trapped and some don die for one building wey fall for Ebute Metta area of Lagos State on Friday.
The building dey opposite Health Centre Ebute Metta along Cemetery Street.Tok tok person for Lagos State Emergency Management Agency, Nosa Okunbor, confirmed the mata plus sey dem dey work to comot pipol from the building.
Federal Government don officially launch the implementation of the second phase of the Partnership for Expanded Water Sanitation and Hygiene (PEWASH) programme to improve access to safe water supply and sanitation for 10 states.
The 10 states for the project na; Katsina, Plateau, Bauchi, Jigawa, Sokoto, Zamfara, Ondo, Osun, Imo and Delta.
Minister of Water Resources, Mr Suleiman Adamu, say e dey important for communities for the 10 states to take ownership of the programme to enable them benefit from the gains.
National
People’s Democratic Party(PDP) don demand for the resignation of President Muhammadu Buhari cos of the cases of corruption for federal agencies.
National chairman for the opposition party, Prince Uche Secondus, yarn this for media talk inside Abuja.
He talk the ongoing corruption investigations of the NDDC, MIC, NEDC, NSITF, EFCC and others, he say Nigeria, under Buhari’s watch, dey on ventilator dey fight to breath.
Secondus say corruption don become way of life for Nigerians while Buhari plays the ostrich.
National
Lawmakers for House of Reps want make President Muhammadu Buhari to call the management of the Nigeria Social Insurance Trust Fund (NSITF) wey dey suspension back to work.
The House make the resolution when dem read the report of dem committee wey investigate wetin them describe as the arbitrary breach of presidential directives by the minister of labour and employment, Senator Chris Ngige
AFRICA
data from the health ministry say authorities for Kenya never fit to trace 13,000 people wey come in contact with people wey later test positive for Covid-19,
for inside 14,168 cases wey dem record, dem never fit track about 10,433 people wey come in contact with them.
The capital, Nairobi, get the highest number of contacts wey dem gats trace followed by the coastal town of Mombasa.
Foreign
President Donald Trump don scrap plans for Republican National Convention celebration for Florida wey suppose draw more than 10,000 people to place where be pandemic hot spot to celebrate him renomination.
Trump been don already move the convention’s public events comot North Carolina because of virus concerns.
Sports
Former world heavyweight championMike Tyson, wey retire for 2005, say he go make comeback for age 54, fight Roy Jones Jr. on September 12 for Los Angeles.
For him Legends Only League website, Tyson announce the eight-round exhibition bout against Jones, wey be 51-year-old fighter wey been hold the heavyweight title con fight enter him 50s.
Sharp sharp news ontop correctfm. na here you go hear all the tori wey dey happen for awa country and obodo oyinbo for 24th July, 2020
"This is not a pipeline blast, it is a bomb blast" - as CorrectFM's Mayowa spoke to Abule Ado in Amuwo Odofin Blast survivors in this Special coverage by Correct FM. Properties worth billions were lost in the pipeline explosion which occurred at the Abule-Ado area around Festac town in Amuwo Odofin Local Government area of Lagos State with Many people were feared dead and several collapsed buildings and Correct FM Mayowa was on ground to speak to witness, survivors and friends of the explosion - he tells Ona all about it.
Correct FM Presents the Abule Ado in Amuwo Odofin Blast Special Report.
From the publisher's feed