Many pipol dey trapped and some don die for one building wey fall for Ebute Metta area of Lagos State on Friday.
The building dey opposite Health Centre Ebute Metta along Cemetery Street.Tok tok person for Lagos State Emergency Management Agency, Nosa Okunbor, confirmed the mata plus sey dem dey work to comot pipol from the building.
Federal Government don officially launch the implementation of the second phase of the Partnership for Expanded Water Sanitation and Hygiene (PEWASH) programme to improve access to safe water supply and sanitation for 10 states.
The 10 states for the project na; Katsina, Plateau, Bauchi, Jigawa, Sokoto, Zamfara, Ondo, Osun, Imo and Delta.
Minister of Water Resources, Mr Suleiman Adamu, say e dey important for communities for the 10 states to take ownership of the programme to enable them benefit from the gains.
People’s Democratic Party(PDP) don demand for the resignation of President Muhammadu Buhari cos of the cases of corruption for federal agencies.
National chairman for the opposition party, Prince Uche Secondus, yarn this for media talk inside Abuja.
He talk the ongoing corruption investigations of the NDDC, MIC, NEDC, NSITF, EFCC and others, he say Nigeria, under Buhari’s watch, dey on ventilator dey fight to breath.
Secondus say corruption don become way of life for Nigerians while Buhari plays the ostrich.
Lawmakers for House of Reps want make President Muhammadu Buhari to call the management of the Nigeria Social Insurance Trust Fund (NSITF) wey dey suspension back to work.
The House make the resolution when dem read the report of dem committee wey investigate wetin them describe as the arbitrary breach of presidential directives by the minister of labour and employment, Senator Chris Ngige
data from the health ministry say authorities for Kenya never fit to trace 13,000 people wey come in contact with people wey later test positive for Covid-19,
for inside 14,168 cases wey dem record, dem never fit track about 10,433 people wey come in contact with them.
The capital, Nairobi, get the highest number of contacts wey dem gats trace followed by the coastal town of Mombasa.
President Donald Trump don scrap plans for Republican National Convention celebration for Florida wey suppose draw more than 10,000 people to place where be pandemic hot spot to celebrate him renomination.
Trump been don already move the convention’s public events comot North Carolina because of virus concerns.
Former world heavyweight championMike Tyson, wey retire for 2005, say he go make comeback for age 54, fight Roy Jones Jr. on September 12 for Los Angeles.
For him Legends Only League website, Tyson announce the eight-round exhibition bout against Jones, wey be 51-year-old fighter wey been hold the heavyweight title con fight enter him 50s.