Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
Una welcome to GEEROH'S Box😘 The confirm podcast wey u need💃 We dey here to dey give una all the ogbonge infomate wey u need to learn about life, love, health, relationship, marriage and even b... more
FAQs about GEEROH'S Box:How many episodes does GEEROH'S Box have?The podcast currently has 11 episodes available.
March 13, 2021Wetin Make Your Business No Dey Grow?🤔With the way things dey go for we country almost everybody dey do their personal business, but no be all the business kan dey grow as we expect.shey u know why? na because most people dey always attach themselves too much with the business,them dey chop pass wetin dem dey put for the business. Oya listen to this episode to hear how u fit make ur business grow....more11minPlay
March 06, 2021Shooting your shoot as a woman🤔sey e dey okay?As a woman shooting your shoot no mean say you cheap, or say you no get level instead e show say you be woman wey sabi wetin she want&they go for am but e get some kain situations wey you no nid shoot am. This episode go explain am give you...more15minPlay
February 27, 2021How To Build The life Wey You LoveMost of us today find ourselves for where we no expect because of the way the country be, some don even forget their dreams and the ones wey still dey chase their dreams na through their Plan B. So Ask yourself shey I get PLAN B?...more7minPlay
February 19, 2021MARRIAGE: Finding MR or MRSInstead make you find soulmate find your missing part, person wey go complete and compliment you.Remember say wetin you no fit collect for marriage no pretend or collect am wen una dey date. This episode go gist abt wetin you nid check wen you dey find partner....more10minPlay
February 06, 2021RELATIONSHIP: Shey Cheating Good For Relationship?Some people (Single) talk say cheating dey help dem fit know &choose which partner dey okay for dem to settle with, and odas say(married) e dey help dem ease marital stress. Wetin be your own answer shey na Yes e good abi na No. Listen to this episode to hear the confirm answer....more9minPlay
January 30, 2021LIFE: Your Money💰Or Your LifeMoney sweet, e good,e dey important,na d only tin wey fit carry you go anywhere for this world but e no fit bring u back or replace u wey be the driver. So think am wella bcos e get somethings wey u dey do wey show say u prefer money dan ur life. This episode go gist u about those tins....more4minPlay
January 23, 2021LIFE: Why me🤔(wetin to do)Dis na question wey every1 don reason either na say no work, health mata,failed marriage,wen person wey u love die& many more. But d tin na say u no nid worry too much again bcos ur own beans go soon durn....more6minPlay
January 16, 2021LOVE: Special Announcement 4MenTo b man no easy bcos u get plenty things wey u dey tink of n sometimes u fit forget the little things wey b koko.This tori talk abt 13 things wey u as man no nid eva try wit ur woman bcos body fit dey pepper her 4 sum tins bt she no go just tell u....more6minPlay
January 14, 2021LIFE:Talent wey u nid get as womanShey u knw say as woman e get sum kan talent wey u nid showcase wey go make u b better wife,sister,mother or even oga for work. Yes we gree say nobody wan old so e even get some kan tins wey u nid do to kip u healthy and young....more7minPlay
January 02, 2021LIFE : 2021 na new fight plan nowWe know say 2020 na one Kan tough year wey shake everybody starting from the coro matter to lockdown n from deir enta end sars protest,even people loose life,job,property and things Kan ova deir. But the good thing na say e give us break time to pause , think our life and see how we need tighten our seat belt. This podcast go tell us wetin we fit do make 2020 no repeat e self for 2021....more7minPlay
FAQs about GEEROH'S Box:How many episodes does GEEROH'S Box have?The podcast currently has 11 episodes available.