Pidgin Vibez

Pidgin Vibez

By Pidgin VibezNews
Download on the App Store

Pidgin Vibez episodes

  • SUPER EAGLES 4–1 GABON | World Cup 2026 Qualifier Wahala

    Super Eagles no even gree breathe as dem burst Gabon 4–1 for dis World Cup 2026 Qualifier showdown. Na pure football madness as Naija boys show class, ginger, and correct finishing.

    If you dey love Naija football, dis match na one you no suppose miss at all.

    Abeg LIKE, DROP your thoughts for comment section, and SUBSCRIBE make you no miss any Super Eagles update, highlights and all World Cup 2026 gist.

    4 min
  • Benin Mini Bus Don Turn Trap? Kidnap Gist Wey Go Shock You

    My pipo, wahala don burst o!
    Mini bus wey we dey use waka for Benin City don turn sometin else. Dem say some bad guys don dey use am for kidnap, robbery, and oda evil waka.

    For dis yarnings, we go yarn una:
    How dem dey run di kidnapping inside mini bus for Benin.
    Wetin you go check before you enta any bus.
    Small-small safety tips wey fit save your life.

    Make you no just listen alone, like, share, and subscribe so evri bodi go sabi wetin dey happen for our city.
    Togeda we fit make Benin City safe again.

    #BeninCity #MiniBusWahala #KidnappingAlert #StreetTalk #NaijaSafety

    5 min
  • BENIN–SAPELE ROAD DON CAST 😭 | See As Pipo Dey Suffer for Dis Bad Road

    Omo! Dis Benin–Sapele road don turn sometin else oo.

    Pipo dey suffer, motors dey break down, trailers dey fall, and no single help from goment.

    Evri day drivers dey beg make dem fix am but notin still happen. Persin fit spend hours for just few kilometers because of pothole wey big pass swimming pool.

    Abeg listen till di end, drop your comment, like, and subscribe make we dey expose all dis kind wahala for Naija roads.

    6 min
  • Work Don Hot! Flyover Bridge Dey Rise for Ramat Park for Benin City

    My pipo, work don really choke for Ramat Park Flyover Bridge inside Benin City o.
    Dis bridge project na one of di biggest wey dey happen for Edo State right now, evri wia don full wit caterpillar, concrete and heavy machine wey dey reshape di whole area.

    No forget to like, share & subscribe for more Benin City updates, Naija construction gist, and Edo State development.

    4 min
  • Arsenal Don Climb Top Again🔥

    Arsenal don show say dem no dey play dis season.
    Gunners don waka go top of di Premier League table afta anoda mad performance wey scatter evri wia.
    Arteta boys dey on fire, but you think say dem fit hold dis top till end of season?
    No forget to like, drop comment, and subscribe make you no miss any Arsenal gist again.

    6 min
  • OBA Market Renovation for Benin City - See as di Place Don Turn!

    My pipo, dis na di real update on OBA Market renovation for Benin City.

    We waka reach di market ground to see how far work don go, how e dey affect traders, plus wetin dey sup for di area now. You go shock wen you see di current state.

    If you dey from Benin City or you sabi Edo vibez, you go feel dis one wella. No forget to like, drop your comment, and subscribe make you no miss any Benin or Edo State update as e dey hot.

    Drop your thought for comment, dis renovation go help traders or e go stress dem more?


    3 min
  • CAF Reject Naija Refs Again 😳

    CAF don shock Nigerians again as dem reject Naija referees for anoda major African football tournament!.
    Why CAF no dey trust Nigerian refs? Na bias, politics, or poor performance?

    Make sure you like, drop your take for comment, and subscribe so you no miss any fresh football gist wey go drop next.

    4 min
  • Naija Safe Like Dis?

    Naija na one of di most lively kontri for Africa, but di big wahala be, Naija really safe like dis for 2025?

    Di way our young pipo dey find moni dis days dem dey do evri tin and anytin for di moni to come.

    Di yarnings na about wetin no good wey come be normal for our surroundings.

    Abeg no forget to like, drop comment, and subscribe.


    5 min
  • Arsenal Shock Man United 1-0 for Old Trafford | Premier League 2025/26 Opener ⚽

    Na wahala opener be dis one o! Arsenal don knack Manchester United 1-0 for Old Trafford as Premier League 2025/26 season start.

    Di match choke, Gunners show strong defence, sharp ball play and dem still run United down for dia own home.
    Arteta boys carry 3 points waka comot Old Trafford, Red Devils fans shock scatter.


    No forget to like 👍, drop your comment 💬 and subscribe 🔔 for more Premier League gist, and football mata.

    4 min

About Pidgin Vibez

From the publisher's feed

Welcome to Pidgin Vibez Podcast!