Pidgin Vibez

Pidgin Vibez

By Pidgin VibezNews
Download on the App Store

Pidgin Vibez episodes

  • Why Married Women Dey Cheat Anyhow for Naija | Wetin Really Dey Happen?

    Wetin dey make plenty married women for Naija dey cheat on top dis husband?

    We unpack all di real gist wey dey cause infidelity for Nigerian marriage today.

    Na time to ask, Na who fault am? Men or women? Or na society wey don spoil?


    No dull, like, drop your comment, and subscribe to catch more hot gist about Naija lifestyle, relationship gbege, and society mata.

    5 min
  • Gym Don Turn Runway? Babes Dey Show Skin Like Say Na Fashion Show

    Na wah oh! Dis gym no be normal again babes dey pull up wit outfits wey go make you shout β€œJesu!

    From crazy crop tops to tight leggings wey leave notin to imagination, di gym don turn mini runway.

    Wetin really dey happen? Na confidence or clout chasing?

    Listen, drop your hot take for comment, and make sure you LIKE, SUBSCRIBE, and ON BELL πŸ”” for more crazy gym trends, fashion wahala, and lifestyle gist.

    5 min
  • Naija Rain Wahala No Be Here | You Gats Know Wetin Happen

    Omo! Once rain start for Naija like dis, na gbas gbos full evri wia.

    We go yarn wetin we dey face anytime rainy season land and wetin we go gat do to see play safe.

    Whether you dey Benin, Lagos, PH, or anywia for Naija, you go relate sharp-sharp.

    Na real-life Naija rainy season wahala we package for here o.
    Make you listen till di end, laugh small, and if e touch you LIKE, COMMENT & SUBSCRIBE sharp-sharp.

    No forget to drop your own rain gist for comment section. We dey wait.

    5 min
  • Dis FIFA Club World Cup Mata - E Really Worth Am?

    Abeg make we tok true, dis FIFA Club World Cup wey FIFA dey always hype, e really make sense? Abi na just anoda jamboree wey no get beta impact?

    Na European clubs dey win am evri time, fans no dey too show, and di whole tin dey feel like say na moni runs.

    Di players dey play too much games, but clubs need di moni.

    Na real football tok we dey do here.
    πŸ’¬ Drop your take for comment.
    πŸ”” No forget to like, sub and knock dat bell, e go help di mata.

    4 min
  • DENGUE FEVER DON LAND FOR EDO STATE

    Dengue Fever don show face for Edo State and e no dey smile at all. Pipo dey sick, hospital don full, and fear dey evri wia.

    For dis video, we go run am as signs wey you go see, and how you fit take protect yourself and your pipo.

    Na mosquito dey carry di Dengue Fever, no dull o!

    If you dey Benin or anywia for Edo, dis gist na for you.

    πŸ“’ Make you watch am sharp-sharp and share give your people. E fit save life o!

    πŸ‘πŸ½ Like, drop comment, and subscribe if you dey feel di vibez, updates full ground!

    4 min
  • ADC Coalition: Na Setup Abi Na Blessing?

    Wetin be dis ADC Coalition wey evri bodi dey tok about?

    Na beta plan for di future of Nigeria politics or just anoda political waka-pass?

    Join di conversation drop your thoughts for comment section

    Make sure you like, subscribe & tap dat bell so you no go miss any gist.

    5 min
  • Wetin Dey Worry Arteta? E Don Go Collect Anoda Chelsea Player

    My pipo, Arteta no wan rest oh! Afta all di Chelsea players wey e don eye, e don dey drag Noni Madueke now join Arsenal wahala.

    Na wetin dey really sup? Dis video go break down why Arsenal dey rush Chelsea boys like say na Black Friday sale.

    Drop your mind for comment section.

    You reason say Madueke go deliver for Arsenal or Arteta just dey craze for Chelsea players?

    Abeg no dull, Like, Comment, and Subscribe for beta football gist and transfer tori.

    4 min
  • 2Baba Apology: Wetin Really Dey Happen?

    Omo! Afta dat podcast wey 2Baba do wit Nedu, baba drop one apology video wey dey confuse evri bodi.
    Wetin make am dey apologize?

    Who dey record am?

    Pipo don begin tok say baba attitude and im doings no clear, and social media don scatter wit reaction.

    No dull, drop your opinion for comment, like di video, and make you subscribe for more Naija celeb gist!


    5 min
  • E Don Happen! Kepa Don Sign for Arsenal | Arteta No Send Anybodi

    Omo, e don set!

    Kepa Arrizabalaga don waka enta Arsenal camp gbagam

    Mikel Arteta no dey play at all dis one na serious gbos gbos for Premier League o.

    No dull!

    Abeg LIKE, DROP COMMENT, SUBSCRIBE and tell us if dis move make sense or e be wahala.
    Make we reason am togeda

    Who go chop bench now? Kepa or Raya?

    Drop your take below πŸ‘‡πŸΎ


    4 min
  • Wizkid Don Cancel Tour?! Wetin Really Happen Go Shock You

    Omo e don happen! Wizkid don shock evribodi as e cancel im tour just like dat .

    Na health wahala? Low ticket sales? Or dem dey hide sometin for back?

    Make una no reason am alone , for dis episode, we go run full gist wey dey street and wetin fans dey yarn.

    Starboy no show face again , see wetin go really make am cancel dis tour. Na full breakdown be dis!

    Abeg no dull! Like, drop comment, subscribe and tap bell make you no miss any latest Naija entertainment gist.

    πŸ‘‡ You shock? Drop your mind for comment section.

    5 min

About Pidgin Vibez

From the publisher's feed

Welcome to Pidgin Vibez Podcast!