
Sign up to save your podcasts
Or


For dis episode my yarnings go dey come from wetin Cristiano Ronaldo tok, wen he say Saudi League beta pass French Ligue 1.
I touch about why di yarnings get small truth inside, and why lack of funding see dey affect di league.
For una opinion who una reason say beta pass between di Saudi League and di French Ligue 1?
For dis episode my yarnings na about Burna Boy.
I tok about why Nigerians dey always over react wen di matter na always about Burna Boy?
I yarn about how Nigerians need to do beta and try dey respect all dis artistes, as e be say di guy don tok am say make fans no dey run enta im stage wen im dey perform.
I see yarn on di guy decision to end im performance for di Lagos countdown show for 31st nite.
And di statement make im come release afta say im get PTSD.
For dis episode my yarnings go be about di Queen of Afrobeats, Tiwa Savage.
Di tori na about her post about say her new album wey go soon drop fit be her last album, as she say she don tire and she self don try.
I yarn about how Nigerians need to value her more and give her, her flowers, I see talk about how she dey represent for different gene of music.
How she see pave way for female artists for di Nigeria music industry, her consistency and di fact say she don remain for top for over a decade.
She go always remain di Queen of Afrobeats e no matter who dey now or who go come for future, dat crown na her own.
Dis episode na about sky Jesus birthday.
I yarn about how we need to dey observant for di drinks wey we dey take in dis period.
I yarn about different safety measures.
I see yarn about how as e be say na season of love, make we spread love to pipo wey dey around us as notin too small to take put smile for pipo face.
For dis episode my yarnings na about
I yarn about di rumour wey be dey
I yarn about am choosing Nigeria
How he always dey available to
How he no allow wetin happen for Fulham define im career.
For dis episode I yarn about how BIODUN STEPHEN na di real GOAT for Nollywood.
Roses & Ivy na must watch for evri bodi, lessons dey for una to learn.
Di movie na solid 9/10, di cast, di costumes, evri tin give wetin e suppose give.
Make evri bodi wey involve for di making of dis film take dia flowers, dem too much.
For dis episode I go dey yarn about Chelsea so far dis season.
I yarn about how Chelsea na league favourite even though say dia manager dey deny am.
I tok about di unity for di team now.
I yarn about how Arsenal no serious to win di league and how dia manager no get di courage to take make big decisions.
I come yarn about how Liverpool, Manchester City and Chelsea be di Favourites for di title.
For dis episode I go dey discuss about di Premier League match between Arsenal and Manchester United yesterday for Emirate Stadium.
Di Arsenal corner kick and if corner kick na part of football?
Why Manchester United fans and dem Legends dey rant about corner kick?
For dis episode I go dey yarn about wetin dey happen so far afta di Edo election.
Di probe of di old administration.
Di crowd wey dey follow di new govnor.
And di many tok tok wey dey happen between di old and new administration.
For dis episode I go dey discuss about di wahala wey Manchester City dey and how Rodri injury dey affect dem di way e take affect Arsenal wit Saliba dat year.
From the publisher's feed