Pidgin Vibez

Pidgin Vibez

By Pidgin VibezNews
Download on the App Store

Pidgin Vibez episodes

  • Public Bus Safe Like Dat? Wetin Dey Happen Inside Go Shock You

    You dey enta public bus steady? You go wan listen first!

    We run street check on wetin dey really happen for inside public bus, from small gbege to serious wahala wey fit happen anytime.

    We tok true tok about how to shine eye, stay safe and no carry last inside any public bus. .

    Whether na daily hustle or one-time waka, dis yarning go open your eye.

    πŸ”” Abeg like, drop your take for comment, and subscribe if you dey feel am.
    πŸ‘‰ Tag your guy wey dey always enta bus, e go tank you lata.

    6 min
  • EFCC Don Carry Persin Again! Wahala For Naira Spraying

    Gbege don shele again o! EFCC don knack arrest on top say persIn dey spray naira for party like say na tissue.

    For dis episode, we go run you di full mata, how e take happen, wetin EFCC yarn, and di kind wahala wey dey wait anybod. wey still dey plan do am.

    You wan flex? Beta shine your eye.

    EFCC no dey smile again!


    Abeg LIKE, DROP COMMENT & SUBSCRIBE sharp-sharp for more beta gist wey dey hot for Naija.

    You feel say EFCC dey do too much or dem dey try set example?

    Tok your mind for comment.

    6 min
  • Mama & Papa, See Why You Must Visit Your Pikin for Skul Witout Notice!

    Mama & Papa, you sure say you sabi wetin your pikin dey do for skul? πŸŽ“πŸ€” Some students get double life, one for house, anoda one for skul! If you no waka go check dem witoutnotice, you fit open eye see tins wey go shock you! 😨

    For dis episode, we go yarn:
    βœ” Why e important to surprise yourpikin for skul πŸ‘€
    βœ” Shocking tins wey parents dondiscover 😱
    βœ” How e go help your pikin stay focusedand responsible
    βœ” Best way to balance trust andmonitoring πŸ“–

    No wait make dem tell you story, waka go see am yourself! πŸ“’ LIKE πŸ‘, COMMENT πŸ’¬ wetin you think, and SUBSCRIBE πŸ”” for more family and lifestyle gist!

    7 min
  • UEFA Champions League Round of 16 Draw

    Omo! UEFA Champions League Round of 16 Draw don land, and e choke! 😲 See as big teams dey jam dem selves for knockout stage.

    Who go qualify? Who go shock evri bodi? We go break down all di matchups, analyze di key battles, and drop our predictions!

    πŸ“’ No forget to LIKEπŸ‘, COMMENT πŸ’¬ your predictions, and SUBSCRIBE πŸ”” make you no miss any UEFA Champions League gist!

    9 min
  • Liverpool Fit Win All 4 Trophies Dis Season? | Dem Go Make History?

    Liverpool fans, una feel say dis season go be d season of dreams? Arne Slot boys dey fight for all fronts, but e still sure say dem fit carry all 4 trophies?

    For dis yarning, we go break down Liverpool form, key matches wey remain, squad strength, and d wahala wey fit stop dem!

    Dem go make history or na anoda heartbreak go land?

    Drop your prediction for comment section!

    You believe say Liverpool fit win all? Tell us wetin you think!


    No forget to LIKE , SHARE & SUBSCRIBE for more football gist!

    5 min
  • Arsenal Celebration vs Man City – E Too Much or E Make Sense?
    Arsenal celebration afta dem beat Manchester City don cause serious wahala!
    E too much or dem get right to celebrate like dat? Some people dey vex say e no make sense, while odas say na pure passion afta dem fight hard for di win.
    Wetin you think?
    No forget to LIKE, COMMENT, and SUBSCRIBE for more football gist and analysis!
    Drop your opinion for comment section: Arsenal do too much or e make sense?
    Turn on notification so you no go miss any update!
    5 min
  • Hard Drugs Wahala: Silent Crisis Wey Dey Spoil Lives!

    Hard drugs wahala don pass be careful!

    For evri wia, drug abuse dey scatter lives, break families, and increase crime. Dis mata no get boundary. But why e dey spread like wildfire? Who dey behind am? Wetin we fit do stop am?

    For dis eye-opening video, we go break down:

    Di real wahala wey drug abuse dey cause for society
    How hard drugs dey affect pipo life
    True life stories of pipo wey don fight addiction
    Di role of cartel, goment, and police for dis mata

    Make you listen till di end and drop your thoughts for comment section. Make we join hand stop dis deadly wahala!


    Subscribe for more beta content!
    Like, Share & Comment make di message spread!

    6 min
  • Nollywood & Cinema Gbese

    Dis episode di yarnings na about di issue wey film makers for Nollywood dey get wit Cinema.

    So I come discuss weather na di duty of di cinema to dey promote one film pass di oda film?

    I come see yarn weather e make sense make cinema staff dey try totori your mind to watch one film even though say no be dat film you say you won watch.

    Dis one and more na full di yarnings for dis episode.


    6 min
  • BurnaBoy vs Cubana ChiefPriest

    Dis episode yarnings na about di on-going beef between Burna Boy and Cubana ChiefPriest

    Who really get di title moni na water?

    So far Burna Boy don help di guy wey say im na Cubana ChiefPriest broda wit 30k dolls, while di woman wey come out say im get son for am, help see dey come for dat one.

    Cubana ChiefPriest don reply say im go help Akpi commot jail.

    Who dey win so far?


    5 min

About Pidgin Vibez

From the publisher's feed

Welcome to Pidgin Vibez Podcast!