Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.
September 22, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa family dem make God for epp us with moni mata and make e make hawa sik pipo well.De message of Hope dey tell us say God love us wel-wel and for dis time wen we dey now make we forlow God waka make we no for miss heaven....more29minPlay
September 21, 2024Praise - God word wen we dey take growToday two song na song wen dey enkorrage us make we pray for evry kondishion wen we dey.De message of Hope dey tell us say make we trust God even wen we see watin make us dey fear and make we know say God go do watin e say e go do....more29minPlay
September 20, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growStory wen we go take know say make we no do odar pipo watin we no want make dem do we bikos we get pawa pass dem.Today message of Hope dey tell us say wen pipo wen get pawa pass us dey find hawa trobo make we cari de mata give God and e go fite for we....more29minPlay
September 19, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe tin dem wen man go do as husband and head for hin family naim bi hawa tork today.Today message of Hope dey tell us say God go ansa de praya wen we pray so dat pipo wen commot for God family go come back....more29minPlay
September 18, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kansa wen dey do woman dem for de road wen dey go de belle wen dem dey take carray pikin naim bi watin doktor put mout today.Today message of Hope tell us say wen we do watin make God happi, God sef go do watin big pass watin we ask am....more29minPlay
September 17, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growWatin bad for de korse wen pikin dem dey korse ish odar wen fit make some pikin go kill demsef naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen wahala wen big pass we come mit us make we pray like Samuel pray and God go fite for we....more29minPlay
September 16, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe tin wen husband and papa for family go do wen hin family go take safe naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen e bi like say watin we dey find no dey come, make we pray like Hannah pray and God go ansa....more29minPlay
September 15, 2024Praya - God word wen we dey take growWe pray today make God epp us fite all de kidnapa and bandit dem wen dey kill pipo for hawa kontree.Today message of Hope dey tell us say wen life no bi as e sorpose bi, make we pray as Moses pray and God go ansa us....more29minPlay
September 14, 2024Praise - God word wen we dey take growToday fess song dey tell us say God na gidigba God wen notin dey shake and de sekond song say na God get dis world so no yawa.De message of Hope say God put time for evrytin wen e do plus as we dey take serve am and make we sef do as Jesus do....more29minPlay
September 13, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growDe kain pipo wen dey jelors and watin pesin fit do to take commot jelorsy naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us say want make we bi kartaka wen know hin word and watin e want and we dey do am as e want am....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.