Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.
September 02, 2024Family mata - God word wen we dey take growAbuse na abat how pesin go dey do watin hin no go like for anoda pesin and na bad tin for family.Today message of Hope say bikos all of us die for hinside sin, we musto give Jesus hawa life so dat we go fit get de beta korret life....more29minPlay
September 01, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya konsign moni wen family go take pay skool fees as new skool year dey start plus make God make techa dem bi beta pipo.De message of Hope dey tell us say beta life no bi plenti moni and propati wen you get but na de life wen Jesus dey give pipo...more29minPlay
August 31, 2024Praise - God word wen we dey take growToday two song na abat God word, de fess one na "Give me de Bybbo" and de sekond song na "Ancient Words"De message of Hope dey tell us say God want make we do all de tin wen e tell us for de ten kormandment....more29minPlay
August 30, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growWen we respet hawa husband even wen e no get moni to do watin husband sorpose do dat one go make hawa husband beta husband.Today message of Hope dey tell us say na God law wen bi de 10 commandment naim bi watin God go take jorge pipo....more29minPlay
August 29, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe odar small small advise wen husband go take korret hin wife wen e no go get wahala for hin marrage.Today message of Hope dey tell us say wen we fear God and we commot hawa hand from sin, God go rite hawa name for hin book....more29minPlay
August 28, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain tin wen pesin go see for hin bress wen e go take know say e get bress kansa naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God get book for heaven wen e dey rite watin we dey do put and na de book e go take jorge we....more29minPlay
August 27, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe way wen hawa pikin dem go take manage deir mind so dat deir mind no go come bi devo workshop.Today message of Hope dey tell us say God jorgement wen dey come so no get sekret oh, na open mata for God eye....more29minPlay
August 26, 2024Family mata - God word wen we dey take growfAnoda tin wen go epp papa and mama train deir pikin well na make dem dey take strong hand and mind take dey train deir pikin.Today message of Hope dey tell us say God judgement dey front dey come and e no get enitin wen we go do take dodge am....more29minPlay
August 25, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God epp us setto de wahala wen dey dis gorment, de petro wahala with Dangote and worka dem salary mata.De message of Hope dey tell us say God don start to dey jorge dis world and e no go tay no Jesus go come....more29minPlay
August 24, 2024Praise - God word wen we dey take growToday fess song say God take dis richusness take dash we and de sekond song say make we stay hinside Jesus.De message of Hope say pesin wen say hin fit richus by hinsef na sef richus pesin and dat one no good bikos na only Jesus fit give us richusness...more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.