Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.
December 29, 2023Woman dem mata - God word wen we dey take growMoses mama wen hin name na Jocabed naim we hear hin stori today and we see say hin bi korret mama wen we go fit resembo.Today message of Hope tell us say God want make we trust and believe am and as we believe am e go do beta beta tin for hawa life....more29minPlay
December 28, 2023Family mata - God word wen we dey take growToday lesin na say no two pipo bi de same so make we no let devo tell us say we too diffren to fit stay togeda as husband and wife.De message of Hope dey enkorage us say make we trust God bicos naim bi hawa Shephad wen no go let we hungry....more29minPlay
December 27, 2023Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe bad bad tin wen korfi dey do for pesin bodi and why we no sorpose dey drink korfi naim bi today mata.Today message of Hope tell us say we bi God sheep and God go kip we and notin wen bad go fit do we bicos God na hawa Shephad....more29minPlay
December 26, 2023Pikin dem mata - God word wen we dey take growWatin and watin hawa pikin dem go do if dem tru-tru wan kontro demsef and bi beta pipo naim bi today mata.Today message of Hope say even wen we take kro-kro eye take commot God from hawa life, like de prodiga pikin, God love go still dey draw we....more29minPlay
December 25, 2023Family mata - God word wen we dey take growToday lesin na watin husband go do to take put trust for him marrage wen hin wife forlow anoda man.Today message of Hope say as moni wen loss no know say e loss na so we loss but God love us and e send Jesus make e die to save we....more29minPlay
December 24, 2023Praya - God word wen we dey take growWe dey kristmas time so hawa praya na make God save us wen we travel from kidnapa, Police and Road Safety pipo.Today message of Hope tell us for hinside de stori abat de man wen hin sheep loss say God love us and God don do evrytin to take save we....more29minPlay
December 23, 2023Praise - God word wen we dey take growToday fess song na "Behold" wen mean say look as hawa God big reach and de sekond song dey ans how we go fit take tell God say we love am?De message of Hope say church get good and bad pipo and only God naim go fit commot de bad pipo wen de time reach....more29minPlay
December 22, 2023Woman dem mata - God word wen we dey take growRebeca stori as e take bi beta pikin dey epp and respet pipo and how Isaac take marray am naim we tork today.De message of Hope tell us say hawa hat bi like ground and God want make hawa hat bi beta ground so dat hin word go grow for hawa life....more29minPlay
December 21, 2023Family mata - God word wen we dey take growNa lie for pesin wen dey do bad tin to say hin no go fit change, with God epp, pesin wen tru-tru wan change go fit change hinsef.De message of Hope say wen we resembo Jesus for hawa karacta, odar pipo go bicos of us give Jesus deir life....more29minPlay
December 20, 2023Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe advise na say make we no dey so so drink kold wata and drink bicos e fit make hawa head, belle and odar pat of hawa bodi no work well.Today message of Hope say we bi God savant and if we do watin God tork we go bi like de wise savant for today stori....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.