
Sign up to save your podcasts
Or


National Identity Management Commission (NIMC) don insist sey e dey compulsory for Nigerians to visit the enrolment centres to complete them National Identification Number registration.
Dem sey e dey important make people no dey carried away with the NIN wey dem get thru Bank Verification Number (BVN) record wey join with them National Identity Database.
the agency tell pipol wey get den NIN through such a process to visit them enrolment centres to validate them number.
Lagos State Police Command say dem arrest atleast 43 persons have been arrested cos dem violate COVID-19 protocols for the state.
The state Police Public Relations Officer, CSP Muyiwa Adejobi, say them arrest the violators for Eclipse Night Club for Victoria Island on Sunday.
He say dem transfer the violators to the Task Force on Environmental Sanitation and Special Offences (Enforcement Unit) for prosecution on the orders of the state Commissioner of Police, Hakeem Odumosu.
Academic Staff Union of Universities say after den look the COVID-19 protocols for the universities them see sey the institutions no ready for safe reopening.
The union talk this one based on the directive of the National Universities Commission sey universities fit resume on January 18, but must obey COVID-19 protocols for hostels and lecture halls.
ASUU say although dem members dey ready to start work, government neva put measures in place for safe reopening of the schools.
dey informate untop di matta wey dey happen for awa country nigeria and latest news for obodo oyinbo.
Federal Government go need about N2.44tn for the vaccination of 164.8 million Nigerians, wey no fit get access to free vaccines wey the country dey expect from the international community.
Coronavirus vaccines dey available for world like the ones Pfizer, Johnson & Johnson, Oxford and Novavax.
Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria and obodo oyinbo.
Lagos State Government don order all public and private schools for the state to reopen for the second term 2020/21 academic session from Monday, 18th of January, 2021.
Na Commissioner for Education, Mrs Folasade Adefisayo talk this one
She say this one dey in line with the Federal Government’s directive plus the second wave of COVID-19 Pandemic.
Adefisayo tell all schools sey make dem make efforts to comply with all the outline Covid-19 requirements for resumption schools.
Hear all di tori wey dey happen for awa country Nigeria ontop politics and everi oda matter. No miss the Obodo Oyinbo news too. everything dey ontop correctfm.
hear all di tori wey dey happen for inside awa country and obodo oyinbo ontop news sharp sharp.
hear di latest ontop correct fm. tins wey dey happen for awa contri and obodo oyinbo
From the publisher's feed