Correct FM

Correct FM

By Correct FMNewsNews Commentary
Download on the App Store

Correct FM episodes

  • News Sharp Sharp: 18th December, 2020

    Poland and Bayern Munich striker Robert Lewandowski don get crown as 2020 Best FIFA Men’s Player of the Year.

    Lewandowski beat off competition from Lionel Messi and Cristiano Ronaldo to land the award.

    Lewandowski don be the favourite for the Ballon d’Or, bet France Football decide say dem no go assign am for 2020.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 17th December, 2020

    Federal Road Safety Corps (FRSC) Management say effective 21 December 2020 pipol go use the National Identification Number (NIN) to process of driver’s license,

    This one dey happen after Federal Government’s directive for the harmonisation of citizens’ data by relevant agencies, dem explain sey “all driver’s licence applicants go present them National Identification Number before then attend to dem

    4 min
  • News Sharp Sharp: 15th December, 2020

    Head of the UN children’s agency, UNICEF, say teachers gats dey among the pipol wey dem give priority access to the COVID-19 vaccines.

    She Say Covid-19 pandemic don cus havoc for children’s education.

    Henrietta Fore say to Vaccinate teachers na critical step to put things back on track.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 10th December, 2020

    Nigeria’s former Minister of Finance, Dr Ngozi Okonjo-Iweala, don assure Nigeria and other African countries sey dem go fit access to COVID-19 vaccines from the end of January through the first quarter of 2021.

    She talk this one for inside close door meet wey she get with Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama for Abuja.

    She say international initiative dey work with World Health Organization, the Coalition for Epidemic Preparedness Innovations (CEPI), GAVI and the international community, to make sure sey the vaccines reach developing and poorer countries, cheap and fast.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 7th December, 2020

    Chairmo of Nigeria Governors Forum, Kayode Fayemi, say Boko Haram people wey escape from North-East part of the country dey enter other parts of Nigeria as bandits and kidnappers.

    Oga Fayemi yarn dis one ontop interview for TV as e call for correct approach to take end the wahala.

    E say even if na to declare state of emergency, say e no get opinion ontop am as dem never discuss matter of state of emergency for the Governors’ Forum.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 4th December, 2020

    Management of Arik air don sack 300 staff wey dey work with de. Na today dem yard dis one for one statement.

    Arik air blame the sack to wetin dem see from the covid19 pandemic.

    The company explain say dem go give the people wey dem sack … package with help of aviation unions dem.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 2nd December, 2020

    Lagos State Judicial Panel on Restitution for Victims of SARS Related Abuses don dismiss petition wey wan force N300 million court judgment against the Special Anti-Robbery Squad (SARS).

    Justice Rilwan Aikawa of Federal High Court been award the compensation against the police for the death of one Jimoh Kehinde in 2018.

    Two years after the judge award d penalty, one Paschal Bonu carry the case before the judicial panel as the third petition.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 1st December, 2020

    President Muhammadu Buhari din give military march order to fight the insurgents. He talk this one

    Two days after Boko Haram terrorists kill 43 farmers for Zabarmari area of Borno State.

    He say the marching order no be one-off, but continuous basis, until dem root out the terrorists.

    4 min

About Correct FM

From the publisher's feed

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.