
Sign up to save your podcasts
Or


Fededral gomenent say Obianuju Catherine Udeh, wey people know as DJ Switch, go face exposure soon.
This one na unto her stand for the allege shooting of #EndSARS protesters by soldiers for the Lekki toll plaza on October 20, 2020.
Minister of Informate and Culture, Lai Mohammed, yarn dis one for meeting inside Abuja on Thursday.
Federal Government don yarn say na yellow fever dey responsible for all the recent strange deaths wey dey happen for inside some states plus Delta and Enugu.
Health Minister Dr. Osagie Ehanire yarn this one as him dey address State House Correspondents after online Federal Executive Council meeting wey dem do for inside Aso Rock Presidential Villa for Abuja yesterday.
The minister yarn say Government been dey investigate d disease, say dem collect samples and do research to take understand wetin happen.
President Muhammadu Buhari don give assurance say federal government go meet all the agreements with all the unions inside the education sector.
Oga Buhari yarn this one for inside d 2020 Convocation ceremony of university of Ibadan, as him dey show him concern untop the ASUU strike wey dey go on.
Him beg the lecturers to return back to their duty post.
National Bureau of Statistics (NBS) say the average price per litre wey people wey dey use kerosene pay for October go up to N352.93 in October from N347.98 wey im be for September.
Dem yarn dis one for statement wey dem call “National Household Kerosene Price Watch (October 2020)’’ wey dem get from dia website for Abuja on Tuesday.
The report show say the state wey get the highest average price per litre of kerodsene na Taraba wey dey buy am for N437.50.
Federal goment don show concern onto teachers wey no dey qualified for inside the country.
Dem say the 1.4million teachers for the system no dey enough for over 4.2 million pupils wey dey basic schools.
Federal goment still call state to take successful candidate wey follow for
Federal Teachers Scheme examination.
MOMAS Electricity Meters Manufacturing Company (MEMMCOL) don dey set to train over 300 youth wey no get work.
Dem won train the youth on meter installation to take match with the Presidential Mass Metering Initiative.
Chairman of MOMAS MOMAS Electricity Meters Manufacturing Company, Kola Balogun, tell news people say the movement get aim to develop work capacity of NIGERIA as part of their Corporate Social Responsibility (CSR).
Petroleum Products Marketing company wey be subsidiary of Nigerian National Petroleum Corporation, don increase ex-depot price of petrol..... Dem increase am to N155.17 per litre from N147.67 per litre. wey mean say, filing station go dey sell like 168-170/ltr
Dem yarn dis one for one internal memo wey Tijani Ajani sign. Dem yarn say the new price go start today wey beFriday.
Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don announce 180 new COVID-19 cases for inside the country
This one na the latest development as dem say the total number of the sickness wey dey d country now na 64,516 and na 1,162 people don die from d sickness.
For the cases dem, Lagos get 74; Oyo, 41; FCT, 19; Kaduna, 19; Bauchi, 12; Ogun, seven; Rivers, four; Cross River and Edo get two each.
Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige, on Wednesday say
ASUU no fit claim say dem dey independent when goment dey pay lecturers.
Oga Ngige say dem say freedom of lecturers… the one wey dem call “autonomy” go only dey wen the university dey get dia money by diasef and meet dia needs by diasef.
E yarn dis one wen im dey defend im ministry budget befoe senate Committee ontop Labour and Employment.
sheu sani tweet am say the former governor of Kaduna state Mr. Musa Balarbe don die after living for 84 years. Na one of the governor wey den comot for office during im time.
From the publisher's feed