
Sign up to save your podcasts
Or


The free distribution for electricity meter to houses start on monday for Kano, Kaduna, Lagos and Ikeja distribution company. dis distribution na fulfillment of di promise from President Muhammadu Buhari.
President Muhamadu Buhari don talk say den go bring all the police officer to justice, and dose wey go loot and destroy public and private properties.
West African Examinations Council don yarn say results of 2020 Senior Secondary School Certificate Examination go come out next week.
The results bin suppose come out today bet the exam wey dem bin postpone because of violence for the country affect some of waec office and some of dia operation for the country.
Ontop waec dia twitter handle, dem say dem go yarn the date soon .
ASUU talk say den never call of the strike because den dey wait for the federal government to conduct integrity test for university transparency and accountability solution, PTAS
Federal Government say dem hand over COVID-19 palliatives from the nation’s reserve and other sources to the state governments for onward distribution to the citizens.
Secretary to the Government of the Federation and Chairman, Presidential Task Force on COVID-19, Boss Mustapha, say them hijack #EndSARS protests to inflict great economic costs through destruction, looting of warehouses, plus to enter private homes, shopping malls, jail breaks.
kaduna state government don talk say den go find and arrest all di pipu wey go carry covid 19 food wey den keep to share for the state.
National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) on Sunday tell Kaduna State Government say after looters destroy dia office, dem commot with drugs wey don expire.
Dem yarn say any body wey use the medicine get risk of serious sickness and death.
Director-General of NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, wey alert Governor Nasir El-Rufai about the matter praise state goment say dem take better action to safeguard the health of dia citizens.
den say hoodlums dey scatter the peaceful protest for Lagos intentionally so e no go dey successful.
Federal government talk say den dey owe contractors wey dey build roads for Nigeria money.
Nigerian Army headquarters don deny say dem send soldiers to Lekki tollgate to shoot for were people dey protest.
The army for their social media post say report wey say soldiers dey the toll gate na fake news as dem yarn say no soldier dey the place.
Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State bin announce 24-hour curfew for the state after violence wey bin happen for the state.
From the publisher's feed