
Sign up to save your podcasts
Or


Federal goment yarn say Nigerians go follow as part of people wey go take part for COVID-19 vaccine when dem develop am for commercial quantity.
Na Minister for Health, Osagie Ehanire, yarn dis one for Abuja on Tuesday say anytime wey dem release vaccine as solution for the global COVID-19 pandemic, say Nigeria people no go miss out.
Oga Ehanire, yarn dis one for two-day conference ontop COVID-19, as e say Federal Ministry of Health dey make arrangements to make sure Nigeria get the vaccine when e come out.
One activist wey im name na Kenechukwu Okeke, don file criminal complaint before one Chief Magistrate’s court in Abuja against 50 persons for their alleged roles for the #EndSARS protests wey shele last month.
Okeke yarn say im follow loss im property for theendsars waka and people wey promote am go need face law.
Part of the people wey dey im list na some Nigerian musicians, social media comedians among others.
Senate president don warn the government say make den no ignore youth unemployment, say make den put youth employment and empowerment for the 2021 budget to avoid another protest for the country.
ASUU don accuse di federal government say Federal Government no wan answer them so den go fit stop the strike wey dey happen for Nigerian Universities.
Lagos State Attorney-General and Justice, Commissioner Moyosore Onigbanjo (SAN) don yarn the courts to sharpaly free 253 persons wey police arrest bcos of the #ENDSARS protest inside the state.
Oga Onigbanjo yarn say the Directorate of Public Prosecution (DPP) for inside d state don chook eye put for d temprorary charges wey police file against dem and dem no see any evidence say dem commit any crime.
Nigeria Centre for disease Control. NCDC yarn on Thursday night say Nigeria don get 180 new COVID-19 cases and ma from inside 14 states. the total number of people wey get d sickness for naija now na 63,508.
But nobody don die from the sickness since d last 24 hours. So the number of people wey the sickness don kill go remain for 1,155.
This is according to the latest statistics provided by the Nigeria Centre for Disease Control, NCDC on Thursday night.
President Muhammadu Buhari enter close door meeting with traditional rulers across the country.
Members of National Council of Traditional Rulers of Nigeria (NCTRN) wey Sultan of Sokoto, Alhaji Abubakar Sa’ad lead, dey the meeting.
Dem do the meeting for council chambers of presidential villa, Abuja, and important kings for the country too attend.
Senate plus Federal Government disagree on the N5 billion bailout wey dem approve for airline operators and other businesses inside the aviation sector to reduce the impact of COVID-19 pandemic for dem operations.
Senate ask Federal Government to increase the bailout fund,dem say e too small, Federal Government say dem no fit go pass that amount, as dem get other challenges to deal with.
Chairman, Senate Committee on Aviation, Senator Smart Adeyemi, say e dey important for dem to review the bailout funds for airline operators, cos Wetin d government dey offer as bailout dey too small to make any meaningful impact.
Entrance examination into secondary schools for Kaduna State go happen on Nov. 7,and Primary schools go resume for a new session on Nov. 8, while secondary schools go resume on Nov. 9 after them been dey house cos of Covid-19 pandemic.
Commissioner for Education, Shehu Muhammad, say universities for the state go resumed on Monday plus sey Ministry of Education and the Schools Quality Assurance Authority go gather arrange the secondary schools’ entrance examination and candidates must carry dem passport photographs and birth certificates before dem write the examination.
Tori be say 94 post-graduate students wey dey under Niger Delta Development Commission foreign scholarship for inside United Kingdom go start another round of “we no go gree waka” today.
This one na unto say dem still dey owe school fees and the commission never pay as dem suppose do.
Meanwhile, presido of Niger Delta Students’ Union Government, Negba Goodness, say the waka na embarrassment to Nigeria.
From the publisher's feed