Correct FM

Correct FM

By Correct FMNewsNews Commentary
Download on the App Store

Correct FM episodes

  • News Sharp Sharp: 30th November, 2020

    Defence Headquarters, say United Nations report sey na 110 pipol na him Boko Haram kill on Saturday for Jere Local Government Area of Borno State no correct.

    Coordinator, Defence Media Operations, Maj. Gen. John Enenche, say na, 43 dead body dem recover from Zabarmari area of the northeast state.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 27th November, 2020

    House of Representatives Committee on top Public Accounts, question Federal Government officials on how dem spend the $125m loan wey den collect from the World Bank.

    The committee call pipol wey sign the World Bank account wey belong to the Office of the Accountant General of the Federation where them put the money from there share am to different government bodies.

    Director-General, Budget Office of the Federation, Ben Akabueze, wey appear before the panel for the second time in two weeks, say den capture the money for the 2018 Appropriation Act, plus sey Accountant General of the Federation know about the loan.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 26th November, 2020

    Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, say after the Federal Executive meeting on Wednesday, the committee on border closure wey President, Muhammadu Buhari, set up go soon submit its report.

    She still assure Nigerians sey the borders go soon open.

    For August 20, 2019, the government close land borders to stop smuggling and encourage local production dem still tell neighbouring countries sey make dem check smuggling from them side as part of the conditions before dem open borders.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 25th November, 2020

    Gunmen don kill two pipol for Maigiginya community of Igabi Local Government Area of Kaduna State.

    The gunmen tiff foodstuff.

    Kaduna State Commissioner Internal Security, Samuel Aruwan, confirm the killing. According to am, the gunmen wey attack the community been dey run from security agents wey spoil dem attack for the Kaduna-Abuna highway late Monday night.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 24th November, 2020

    Presidential Task Force on COVID-19 say nothing less than 39,070 passengers, wey enter the country no pay for coronavirus test.

    Chairman of the PTF, Boss Mustapha, say some travellers carry fake documents on COVID-19 tests and other information,he say some of the pipol wey pay for post-arrival test no show up for the tests.

    Mustapha, say PTF dey look the complain of Nigerians with the protocols for testing by in-bound and out-bound travellers.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 23rd November, 2020

    Lagos State Government don call on pipol for the state sey make dem change them attitude to waste management so dem fit check environmental pollution con protect the ecosystem.

    Secretary to the State Government, Mrs. Folashade Jaji, yarn this one for the ceremony of seven-day serious cleaning of Waterways by Mental and Environmental Development Initiative (MEDIC), wey dey collabo with HRM Abisogun Foundation plus other partners

    4 min
  • News Sharp Sharp: 20th November, 2020

    #EndSARS protester, Peter Eromosele Adene, don face freedom after e spend 12 days for police  hand.

    One of the lawyer wey support am for legal matter share video wey show as e free ontop Twitter.

    Police for Lagos bin arrest am on November 7.

    4 min

About Correct FM

From the publisher's feed

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.