
Sign up to save your podcasts
Or


Senate on Tuesday ask President, Muhammadu Buhari to address the nation immediately;.
This one na unto the current nationwide protests by youths against police brutality and bad goment.
Dem still ask police say make dem give the #EndSARS protesters protection to prevent dem from hoodlums wey won con spoil dia genuine action.
Federal Government say Agbero don take over the protest, den beg the protesters make den end am bcos gbege don dey enter inside am
Edo State don set up 12 man judicial panel make den shook eye into the situation of the End SARS protest for the State. The secretary of the state give them 90 days to complete their assignment.
President of the Senate, Ahmed Lawan and the Speaker of the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, don call #EndSARS protesters say make dem stop the nationwide protest.
Oga Lawan and Gbajabiamila yarn dis one on Sunday as dem dey follow State House correspondents yarn after meeting with President Muhammadu Buhari.
The Senate Presido describe the ongoing protests as trying moment for the country and dia leadership.
Tori from US Government website be say dem don ban Nigeria say dem no go follow for the US visa lottery application for 2022
For the 19-page document wey dem publish for the website, Nigeria be the only African country wey dem ban from the visa lottery.
The Department of State dey determine people wey dem dey close through random computer drawing.
Nigerian Bar Association plus civil rights groups don strongly condemn attacks on people wey dey protest against the Special Anti-Robbery Squad of the Nigeria Police.
Protests don dey most parts of the country since Wednesday last week by Nigerians, mostly youths, wey sey make dem cancel SARS, dem accuse police squad of corruption, high-handedness and harassment
Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, don set up Special Weapons and Tactics Team wey go replace the Special Anti-Robbery Squad wey dem bin don disband.
Presidency on Tuesday don approved the five-point demand wey youth bring forward as dem bin don dey protest for the country.
Na Special adviser to oga preside ontop Media and Publicity, Femi Adesina, yarn dis one for one statement.
Part of wetin dey tok na say dem go release the protesters wey dem bin hold without any condition to am.
Pipu wey dey do the hashtag #Endsars waka continue dere waka for different state. Other state like PH join today.
President, Muhammadu Buhari on Monday, address the nation for the first time for the protest matter wey dey go round country.
The protest don go round country and na unto killing wey dey happen by men of SARS wey be Special Anti-Robbery Squad of the Nigeria Police Force.
From the publisher's feed