Correct FM

Correct FM

By Correct FMNewsNews Commentary
Download on the App Store

Correct FM episodes

  • News Sharp Sharp: 12th October, 2020

    The Federal Government don extend the suspension ontop new electricity tariff by one week.

    Prof. James Momoh, wey be Chairmo, Nigeria Electricity Regulatory Commission (NERC) yarn this when the ad hoc Technical Committee ontop Electricity Tariff submit their interim report for meeting between Federal Government and Organised Labour on Monday for Abuja.

    Dem bin suspend the new tariff two weeks and e end on midnight of oct 11.

    7 min
  • News Sharp Sharp: 9th October, 2020

    President Muhammadu Buhari say na only federal workers wey do capture for  Integrated Personnel Payroll Information System (IPPIS) platform go collect salaries.

    Oga Buhari yarn dis one wen im present the 2021 budget of N13.08trillion to  joint session of the National Assembly for Abuja on Thursday.

    Meanwhile, reports tok say Academic Staff Union of Universities (ASUU), wey dey ontop strike, say dem no go key into the Integrated Personnel Payroll Information System (IPPIS) wey goment dey ask of.

    7 min
  • News Sharp Sharp: 7th October, 2020

    Nigeria Economic Society (NES), yesterday, declare say the nation economy dey go bad because dem no add members of National Economic Management Team (NEMT).

    Dia Presido wey be Professor Sarah Anyanwu, wey professors Peter Shibayan and Eyilola Olaniyi of Department of Economics, University of Abuja follow… yarn dis one for visit to the Senate Minority Leader, Enyinnaya Abaribe.

    Dem say people wey dey handle the country economy get small or no experience and knowledge of the economy.

    6 min
  • News Sharp Sharp: 6th October, 2020

    nigeria candidate for the position of the director general for the world trade organization Dr.Ngozi Okonjo Iweala don chop support from the European Union government as the race dey enter the final month. 

    9 min
  • News Sharp Sharp: 6th October, 2020

    National President of ASUU, Prof Biodun Ogunyemi, say Federal Government no dey sincere for dem negotiations with the union, he say lecturers no fit resume on empty belle.

    Ogunyemi say Accountant General of the Federation, Mr Ahmed Idris, dey violate directive of oga President, sey make dem pay lecturers’ salaries.

    He say make Nigerians dey ready for long strike for universities cos of the way wey government take dey handle d negotiations.

    Non-Academic Staff Union say the way wey Federal Government take dey handle Integrated Payroll and Personnel Information System no dey transparent, as den dey cheat many of dem members .

    9 min
  • News Sharp Sharp: 6th October, 2020

    Troops of Operation “Thunder Strike” don kill two bandits and wounds some other people for Abuja/Kaduna highway.

    Na Coordinator of Defence Media Operations, Maj.-Gen. John Enenche yarn dis one.

    E yarn say the troop overpower the bandits with heavy fire wey cause two deaths and dem still collect some weapons from the bandits.

    10 min
  • News Sharp Sharp: 5th October, 2020

    Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, don ban personnel of Federal Special Anti-Robbery Squad the on ewey people dey call SARS say make dem no dey do routine patrols.

    E still ban other squads of the force together with the once wey dm dey call …Special Tactical Squad, Intelligence Response Team, Anti-Cultism Squad say make dem no dey check people again.

    This one dey for one statement by Force Public Relations Officer, Frank Mba, on Sunday.

    7 min
  • News Sharp Sharp: 2nd October, 2020

    Vice President Yemi Osinbajo, don call Nigerian youths say make dem no surrender to the challenges wey the nation dey face.

    E say na Nigerian youth get the key to wetin go make the country more united, peaceful and prosperous nation.

    Vice preside, Yemi Osibajo yarn dis one ontop online meeting of the NASFAT Global Youth Seminar wey dem call “a Unified, Peaceful and Prosperous Nigeria”.

    7 min

About Correct FM

From the publisher's feed

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.