Correct FM

Correct FM

By Correct FMNewsNews Commentary
Download on the App Store

Correct FM episodes

  • News Sharp Sharp: 24th September, 2020

    Justice Oluwatoyin Taiwo of the Lagos State Special Offences Court, don sentence one dismissed policeman, Ologunowa Ojo, to seven years’ for prison cos he kill one man Taiye Akande.

    Ojo, wey be part of the Special Protection Unit, Oduduwa, Ikeja been dey guard one company on February 3, 2016, when he get argument with Akande around 7pm, con shoot am inside Shapati, for Ajah area of the state.

    11 min
  • News Sharp Sharp: 23rd September, 2020

    Federal High Court for Abuja rule sey President, Muhammadu Buhari (retd), follow to break the law when he send the names of 11 candidates wey National Judicial Council suggest for appointment as judges for High Court wey dey Federal Capital Territory to the Senate for screening and confirmation.

    Justice Inyang Ekwo make the pronouncement for suit wey Abuja-based lawyer, Oladimeji Ekengba, file wey dey challenge the forwarding of the names of the 11 nominees by oga Buhari to the Senate he sey e breach section 256(2) of the Nigerian Constitution.

    Oga Buhari without explanation  been pick 11 names from 33 wey dem recommend to am for April this year by NJC for appointment as FCT High Court judges.

    5 min
  • News Sharp Sharp: 23rd September, 2020

    Gov. Nasir El-Rufai of Kaduna state, say im administration don attract 25 new business wey worth over $500 million.

    E yarn dis one for opening of the 5th Kaduna Investments Summit as e say the investment na both by local and foreign companies.

    Governor Elrufai explain say the summit na one of the means wey goment dey use showcase and market Kaduna State to national and international audiences.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 22nd September, 2020

    Nigeria Labour Congress NLC don promise to go ahead with the strike wey dem plan and protest from September 28.

    Dem say dis one na as Federal Government fail to change electricity tariff and fuel price wey go up.

    NLC Presido, Ayuba Wabba, say the action by organised labour go start from next week.

    Oga Wabba still yarn say na 36 chiarmo of the 36 states plus FCT chapter of NLC make the decision.

    7 min
  • News Sharp Sharp: 22nd September, 2020

    Presidential Task Force (PTF),on COVID-19, don warn sey pipol don dey abandon non-pharmaceutical protocols and other measures wey dem put to tackle the spread of the Coronavirus (COVID-19) pandemic for the country.

    PTF chairman and Secretary to the Government of the Federation, Mr Boss Mustapha, say pipol don turn face masks to chin masks, plus sey social distancing and gatherings don return to the pre-COVID era.

    Mustapha, say make pipol dey alert in order to prevent any danger of the second wave of the pandemic as countries for Europe dey face na.

    8 min
  • News Sharp Sharp: 21st September, 2020

    Accident Investigation Bureau (AIB) say the Bell 206-B3 helicopter wey crash for Ikeja area of Lagos state on August 28, come down cos of to inadequate fuel for d tank.

    According to 15-page report wey Accident Investigation Bureau (AIB) release,na that one dem first find plus sey the helicopter get valid certificate of airworthiness con get full-tank capacity on August 27 when dem do 20-minute test-flight.

    AIB’s report still talk sey the helicopter no get fuel jettisoning capacity even though sey eyewitnesses talk sey the pilot release fuel from up, before the crash.

    12 min
  • News Sharp Sharp: 21st September, 2020

    Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don give assurance say the state go start programmes wey go make transportation easy for inside Lagos.

    Im yarn dis one through in  Commissioner for Informate, Mr Gbenga Omotosho for one Traffic Radio.

    Governor Babajide Sanwo-olu hail dem for the creativity and the one wey oyibo dedy call  innovation.

    4 min
  • News Sharp Sharp: 17th September, 2020

    Anti-corruption Unit for Kaduna State Ministry of Justice don train heads of Ministries, Department and Agencies for the state ontop whistleblowing matter.

    Tori be say this one na to make sure say dem dey accountable and dem sabi dia work well for better delivery inside public service.

    The commissioner, still caution say Kaduna state goment whistle blower law still dey in place.

    6 min

About Correct FM

From the publisher's feed

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.