Correct FM

Correct FM

By Correct FMNewsNews Commentary
Download on the App Store

Correct FM episodes

  • News Sharp Sharp: 16th September, 2020

    Central Bank of Nigeria don announce N200 billion mortgage finance loan to Family Homes Fund (FHF).

    The fund na to build 300,000 homes for the 36 states inside the country and  Federal Capital Territory.

    Dem still dey expect say e go create up to 1.5 million jobs for five years.

    6 min
  • News Sharp Sharp: 15th September, 2020

    Central Bank of Nigeria (CBN) don introduce one Solar Connection Intervention Facility.

    Tori be say dis one na to match Federal government scheme wey get focus to expand energy access to 25 million people through provision of solar home systems.>>https://correct.fm/podcast/news-sharp-sharp-15th-serptember-2020/

    3 min
  • News Sharp Sharp: 15th September, 2020

    Lagos State Governor, Mr Babajide Sanwo-Olu, and Minister of Transportation, Mr Rotimi Amaechi go visit the area of the accident wey involve train and two vehicles.

    Sanwo-Olu sympathise with the families of the victims, He say the accident happen on the day wey the state government and Federal Government reach agreement to close down the shopping complex’s gates for the railway line because of safety concerns.

    Two persons die for the Monday accident, wey happen along the driveway to Nigerian Army Shopping Arena inside Oshodi

    9 min
  • News Sharp Sharp: 14th September, 2020

    Kano State Government don order the immediate reopening of six Technical Colleges for the state to allow students for final year class to join for the forthcoming  National Business and Technical Examinations Board (NABTEB) examinations.

    Commissioner for Education, Malam Sanusi Kiru, say the order na follow-up to the approval wey Gov. Abdullahi Ganduje grant.

    The commissioner say the state government don order the immediate payment of the NABTEB examinations fees for all SS3 students inside the technical schools.

    He say dem keep N15.6 million for students’ feeding, while another N860,000   for the upkeep of the respective colleges.

    6 min
  • News Sharp Sharp: 14th September, 2020

    Some bandits don kidnap 16 farmers, wey children and women dey among for Uduwa village, inside Chikun Local Government Area of Kaduna State.

    Tori be say the people wey face the kidnap bin dey go farm wen gunmen attack dem for weekend.

    Four of the people wey dem shoot wound n aim make dem no carry dem bet dem carry the 16 other people wey come from the same family.


    Representative of African Student Union Parliament hail Dr Janet Ekpenyong as im dey present leadership award to am per say she be Director General of the Cross River State Primary Healthcare Development Agency.

    Speaker African Student Union Parliament, Honourable Temple Oliseh, describe Dr Janet Ekpenyong as one of young and hardworking administrator for African.

    This one na unto say e yarn say dem don see ideas wey she don introduce to  Cross River State Primary Healthcare Agency.

    9 min
  • News Sharp Sharp: 10th September, 2020

    Nigeria Police Force don arrest some people wey dey do “we no go gree “ waka for Lagos unto increase for petrol price and electricity tariff.

    Dem arrest dem around Ojuelegba area of Lagos on Thursday.

    Tori be say apart from the people wey dem arrest, dem sgtill carry materials of news people wey dey where e happen.

    One of the people wey lead the group say na 18 person dem arrest and 4 news people dey inside.

    11 min
  • News Sharp Sharp: 9th September, 2020

    Federal, state and local government never talk anything Two weeks after for the release of the students wey armed men carry when dem enter Prince Academy, wey dey Damba-Kasaya village inside Chikun Local Government Area of Kaduna State to kidnap seven students and 1 teacher.

    News Report talk sey the mata happen around 8 a.m. when the students dey prepare for them junior secondary school examination‎. According to the report, the students na JSS3 students wey follow for the students for exit classes wey the government talk sey make dem resume for their Junior Secondary School examination.

    7 min

About Correct FM

From the publisher's feed

Correct FM team in Lagos, Kano, Enugu, Kano, Kaduna, Ibadan (and still expanding) bring you insightful, educative and exclusive audio content all in pidgin. Listen. Subscribe. Share.