
Sign up to save your podcasts
Or


As Nigeria dey mark dia 60 years anniversary, Kaduna state governor, Nasir, El-Rufai dey advoctae for new national agreement.
E say dis one na for the nation collective goals, ontop citizenship, rule of law, diversity, merit, governance, and how powers and responsibilities fit go round between states and federal goment for wellbeing of the country.
Oga El-Rufai tell Nigeria people say dem go need dey confident and hopeful say dem fit make the country dey alright again.
Federal Goment don declare tomorrow wey be 1st of October as public holiday to mark the nation’s 60th Independence anniversary.
Na Interior Minister Rauf Aregbesola announce this one on behalf of federal goment for Abuja yesterday.
Oga Aregebsola say Nigeria be the leading black African country for the world and e no get doubt say Nigeria be pride of Africa and hope to Africa.
Central Bank of Nigeria say one commercial court for London don order the release of $200 million wey dem use as deposit for the case against Process & Industrial Development (P&ID) to the Nigerian government.
Central Bank Governor Godwin Emefiele confirm the news, he say the ruling dey come after the court see sey the case na primo facie fraud.
The court still reject P&ID’s application to increase them guarantee.
AS part of measures to address flood wey dey claim lives and property every year, tori be say Federal Government don perfect plan to establish establish flood control project along the banks of River for Kaduna.
The project go protect residents wey dey battle with flood as dem dey loose farmlands and property when heavy rain fall.
This one na as Kaduna State Goment raise alarm over threat of pollution to River Kaduna.
Lagos State Government don reduce transport fares for Lagos state ferries by 40 per cent.
Managing Director of Lagos Ferry Services, Hon. Abdoulbaq Ladi-Balogun, say the state government do this one to appreciate public cos dem embrace water transportation as alternative means to reduce road traffic, dem do this one to celebrate Nigeria 60th Independence from 30th September to 2nd October.
Bad government na n dey cause security challenges for the country - President CAN Dr.Olasupo Ayokunle.
INEC say dem don learn from Edo State governorship election say better election dey possible for Nigeria with cooperation of all stakeholders.
Chief Press Secretary to the INEC chairmo wey be Rotimi Oyekanmi, yarn dis one for one interview with news people.
Oga Oyekanmi still thanl Oba of Benin, security agencies, civil society organizations, media, National Peace Committee and development partners for the role wey dem play to the peaceful election for Edo state.
Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say dem no record any death for 24 hours for Nigeria inside 24 hours.
Dem yarn dis one for the latest report wey dem give ontop dia twitter handle.
NCDC still yarn say dem record 125 new cases wey bring the total number to 57, 849.
Nigeria no dey build any rail wey go lead to niger republic, di idea na to buil the one wey go reach the border. Minister for Transportation - Rotimi Ameachi na n talk this one.
From the publisher's feed