E get things wey bi say man no fit write about dem but na to yarn about dem, bicos if man wan write about dem tings, man go dey forget wetin to type and man fit bigin dey mis-type YOU KNOW! and e fit make the whole ting kom turn to the "case of wahala dey sleep yanka go wake am up" u know dat cat dey sleep mouse go wake am kind of ting like dat?
Most People no sabi or better yet no wan sabi dey power wey dem brain get, most people too no wan or better yet no sabi the kind POWER wey their tongue get, I swear. 99% of dis erde population dey under mind control, I mean if you don ever attended any form of educational and any form of Religious institution respectively, u bi victim to the power of the Tongue, lol! Una know say mi I no dey like to dey write too much make I no kom dey write wetin I no suppose write, so abeg make una listen to the podcast below.