INNER HEALIN PODCAST

INNER HEALIN PODCAST

Download on the App Store

INNER HEALIN PODCAST episodes

  • We dey shit too much sotay we get trucks to dey move dem shit about lol!

    Waste Management wahala lol!

    The time wey I bi small pikin for my Village in Africa, we bin dey shit inside hole for backyard and the shit wey we dey pass no bin dey too much because we bin dey chop wetin we bin supposed to dey chop, but now we get trucks wey dey drive around dey move our shits and we call am "Waste Management" make we talk about am.....

    25 min
  • A brainwashed homeless person calling another person homeless.

    E get somethings wey bi say when man pikin begin talk about them, e go just make man pikin begin dey shake him head and sometime go make man pikin laugh out very loud.

    Because you feel say you dey sleep inside some sealed off blocks, e dey make you feel safe and at home abi? well I get bad news for you so listen.......

    Home or homeless?

    26 min
  • Why we dey judge and define people base on how good dem communicate English?

    English no bi the official language of Planet Earth abeg, na black people dey like to do that pass, dem go dey do like say English na do or die, if you for Village no sabi yarn English, people go dey look you like say something is wrong with you, dem forget say English no get anything to do with African people, English is the official dialect of the English people for England, so wetin concern us Africans concern English? Make we talk about dis nonsense abeg...

    English  no bi the official language of Planet Earth abeg

    24 min
  • Who Is A True Naijarian? Make we take time define who a Nigerian is lol!

    I no dey always wan yarn about my Country bicos I no sabi wetin to yarn about the country, I don taya, e don tey wen Pipo don dey yarn, dey hala, dey some dey even vibrate on the situation and whala wey dey ravage our Nation wey dey for the Western part of Alkebulan, if you no sabi wetin Alkebulan mean, make you re-read your history and I no mean His-tory.

    Na im make I bin record this Podcast make I share with una......

    21 min
  • His-tory Or Hi-story How Una See Am, Make We Talk About Am?

    Again, oga teacher abeg stop teaching me and my Children nonsense abeg!

    How many of una remember the time wen dem dey teach you for primary school say 1 plus 1 equals 2?

    People dön tell lies for this our planet tey, no bi today dem start to dey tell lies but when lies come enter our Children dem classrooms, na there na im me I get wahala with, na there na im me I no go agree again, e get some level lies wey bi say when dem talk am, e go bring peace, those kind lies I no get problems with bicos na necessary lies but when you begin tell lies simple bicos you wan control some people, na there me and you go wear one pair of trouser. Listen to podcast below......

    31 min
  • Stop With All The Bullcrap And Explain This!

    Why my dodo go be yellow when am only eating leaves and herbs? Teacher abeg no teach me Nonsense ..oooo

    "Blessed are the meek for they shall see God"

    ow, ever since I was a small pikin, dem bin tell me lots of bullshits wey as I don grow older now with some gray hairs, I dön begin dey question some of those bullshit, remember how you were told Mungo Park discovered The River Niger? How Christopher discovered America? now make we yarn about some things wey instead wey you for tell them to stop with the bullshit and explain better, you dey absorbed dem nonsense for head dey carry am about, you no know say e dey fuck up your head. Listen to podcast below.....

    27 min
  • Wanna live longer? Exercise!

    et time wey be say if man pikin wan relax some yeye wahala no go let man pikin relax enjoy the fruit of hm labour. The tricky part be how to take solve dem yeye wahala wey dey bother our lives. E get wetin I need to tell you guys because e get things wey bi say, we must to talk about dem kind things.

    16 min
  • Marriages and Relationships no bi by force abeg! nothing bi by force in dis life

    If you are not happy with whatever it is you are doing, leave! it´s not by force abeg!

    People dey do things sometimes wey bi say dem no suppose do at all, some go dey force themselves stay for place wey no make dem happy at all, see make I tell una now, nothing wey you dey do for this Planet wey dem force you to do, Marriage and relationship dem no bi by force, no bi by force say you must to marry and have Children, your life na you get am so no allow anything mess am up for you, I don yarn my own finish, listen to the Podcast below.

    16 min

About INNER HEALIN PODCAST

From the publisher's feed

Imeh Ibanga is a lifestyle and metabolic health educator whose work is rooted in lived experience.