Pidgin Parlour Crypto Podcast

Pidgin Parlour Crypto Podcast

By Pidgin ParlourEducation
Download on the App Store

Pidgin Parlour Crypto Podcast episodes

  • Make we reason BRC20 tokens!

    Everyday we dey see new things for the crypto space, but dis one wey we wan talk na new thing entirely because many Pipo wey dey crypto Twitter don talk say Im no fit happen.You dey wonder say wetin happen? Na bitcoin blockchain launch token o, and everybody dey surprised because Pipo don talk say Bitcoin na just store of value, others even talk say na shitcoin. But as dem launch dis "BRC20 TOKEN", many Pipo eye don open and dem begin dey reason Bitcoin blockchain again. So for this episode Crossvic and Aishat gather discuss:

    • The origin of dis token

    • How dem dey work

    • The benefits and risk of this token

    • How you fit begin to dey interact with dem.

    If you don dey reason dis matter, this episode na for you.

    Oya go download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you Follow our Twitter :

    https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    46 min
  • Blockchain & Beyond Conference

    Research don talk say Africa dey middle of blockchain revolution wey dey happen for the world as blockchain education dey happen for everywhere across Africa. Pipo, they put dia money for ground make plenti Pipo learn about this new technology and on top today's episode we get "Ezenmo Blockchain" wey be the co-founder of Blockchain UNN come share with us about how this blockchain fit touch every area of the human life. For this episode you learn:

    • Why plenty Africans never know about blockchain technology

    • How we fit fast track blockchain adoption for Africa.

    • Wetin Ezenmuo dey try do for Africa wey dey make am do offline event.

    • Wetin be di future of blockchain in Nigeria.

    As the gist dey hot, dis mata go open your eye. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    44 min
  • Episode title : Founder tori with Lydia Mark, founder of Web3 Woman Hub,

    Many pipo don assume say when we dey talk tech mata, Web3 or blockchain talk make women no put mouth because Im be like na only men dey rule the space. Especially for Africa, di mata na serious one as Im be like say na only for kitchen women suppose dey shine. Na dis matter our guest for today's episode see wey make am say although life no balance originally but for this mata "Things suppose balance". Women suppose dey inside tech, dis passion push am make im establish I'm company "Web3 woman hub" and since dey don enter market, many women don enter web3 space through our guest.Una go learn plenty things for this episode wey go jinja you say nothing dey impossible. If you be woman wey dey build for the space or you get woman wey dey reason say I no fit enter blockchain, Lydia tori go show you the way to go. Oya go download and listenEnjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    43 min
  • Make We reason Optimism - Chain Metrics & Future
    If una don dey follow our podcast on top the optimism ecosystem I know say today gist go sweet una for body as many pipo don ask us say how we fit know if this Optimism wey you dey talk na beta project wey I fit shook my mouth. Na dis question we wan ansa dis week for pidgin palour as Crossvic and Bintuparis take break down the metrics on top Optimism blockchain. For dis episode, you go learn:
    • The on-chain metrics wey you suppose know about Optimism
    • Wetin be this Bedrock laucnch wey Optimism dey plan and how im take concern you.
    • How dem wan take OP stack re-arrange the future of Layer2 solutions
    • You go also get little gist about Dia Retroactive public good funding.
    If you get interest for all dis gist, oya go download and listen to dis episode. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa -https://discord.gg/p
    42 min
  • Make We Reason Optimism

    Optimism na one of the major layer 2 solutions wey dem build to solve the problem of Ethereum scalability. Dis ecosystem good so tey im dey attract several builders wey dey build their project on top am. If you no understand how Optimism take enter market, today's episode go teach you everything wey you suppose know about the optimism ecosystem. You go learn things like:

    • Wetin Optimism be and how dem dey work?

    • Who dem be and wetin be thier history?

    • How you fit start to dey use thier platform.

    • You go learn the application you fit begin dey use on top the platform

    If this mata dey sweet for your heart, oya go download and listen. Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegramhttps://t.me/banklessafrica

    41 min
  • Sui Network : Wetin Dey Sup?

    Sui network don cause kasala for Twitter last week as many pipo dey rant say dem no dey do airdrop. Before we talk airdrop mata, di first be be say:

    • Wetin be Sui network?

    • Wetin be di difference between Sui blockchain and other blockchains

    • Who be di founder of this project and how di network dey take work.

    • Che na true say dem no dey do Airdrop, if them no do, how you fit position yourself for the blockchain.

    If you dey interested in this new blockchain wey dey cause kasala for everywhere, Aishat and Crossvic don bring beta gist on top dis mata for today's episode. No be only your ears go hear am, oya go download and give una neighbors. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    45 min
  • Web3 Marketing - How you fit sell your project for web3

    If you no sabi how you fit sell your project to pipo for dis web3 space, poverty go chop your eye. No cap! But the challenge for many pipo be say dem dey use the marketing strategy wey dem sabi for web2 inside web3 and im dey flop most of the times. Na why we bring Olabisi come this show today (web3 growth marketer) make im explain to us how im dey do marketing for web3 and how any project fit do well for this space. We answer questions like. Wetin be marketing and wetin you suppose know for your marketing to succeed for web3Wetin be the importance of community for dis space and how you fit build active community. Wetin be the active way projects fot grow their social media platforms for this web3Wetin be the best channel to promote your product for this space. If you be Builder for this space or your wan go into web3 marketing, this episode na for you. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    58 min
  • Wetin be Optimistic & ZK rollups?

    Several innovation don come out since the beginning of dis layer 2 scaling solutions.Na there you go find innovations like - Sidechains, Rollups, plasma and channels and all of dem dey come to solve the wahala of scalability on top the blockchain. As all dis innovation dey so, people come dey further ask say which one better pass for all the Layer 2 scaling solutions, na the thing wey I and my co- host(bintu_paris) gather yarn for this episode. So if you get question like:

    • Wetin be the future of this layer 2 solutions?

    • Im dey possible make Optimism or Arbitrum stand alone years to come?

    • Wetin be the difference between Optimistic and Zk Rollups and which one beta pass?

    Dis episode na for you, because una go enjoy the gist and una go learn in a fun way. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    53 min
  • Wetin be Layer 2 solutions and why we need am with Salvi?
    As Una don know say if any blockchain ecosystem go dey perfect, im suppose get 3 things wey be :decentralization, security and scalability. However, no blockchain don get dis features complete.The best of them wey be "Ethereum" get 2 out the 3 features: Decentralization and Security but I'm no dey scalable. Na why transactions dey slow on top ethereum and if im go fast, you go pay plenty gas feeMany pipo don dey find solutions to this problem, na wetin dey bring layer 2 solutions to the limelight be that. So if you no understand wetin Layer 2 be, this episode go show you...
    • Wetin be layer 2 solutions
    • why we need layer 2 solutions
    • The difference between layer 1 and layer 2 solutions
    • Layer 2 projects wey dey make wave currently
    So if any of dis be your concern, this episode na for you.Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica
    31 min
  • Founda tori wey go jinja you for web3 with Denise of Astut Community Management Agency

    Di secrets of pipo wey don make am dey inside dia tori, if you wan do wetin dem dey do, the best thing to do na to listen to their tori. On dis Pidgin Palour Crypto podcast episode we bin get deep conversation with di founder of Astut Community management agency (Denise). Im na young founder wey dey do big things for the web3 space. Im achievement at a very young age na thing wey dey cause many put eye on top wetin she dey do. For this episode, "Denise" open all Im secrets for us so the public fit learn. As you wan listen to this episode, you go learn:♦️ How Im begin her career for the web3 space. ♦️How you fit land gigs for the web3 space. ♦️The importance of social media as una dey build yourself in the space. ♦️Di wahala wey im face wen im start im journey begin for the space. ♦️Wetin dey give this young founder confidence in her journey.E be true say glory no dey without tori. Make you get inspiration as you listen to dis episode.Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us on telegram https://t.me/banklessafrica

    48 min

About Pidgin Parlour Crypto Podcast

From the publisher's feed

Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey…