Pidgin Parlour Crypto Podcast

Pidgin Parlour Crypto Podcast

By Pidgin ParlourEducation
Download on the App Store

Pidgin Parlour Crypto Podcast episodes

  • Airdrops & Crypto 🫱🏾‍🫲🏾
    Oppression full street last week as many airdrop hunter wey partake of arbitrum airdrop no let us rest for Twitter. Dem just dey buga for everywhere say dey don blow. As una don know say dis life no balance. As many people dey rejoice, some people dey sad say dem no dey qualified. Questions come dey fly everywhere about Airdrops and how dem they work, na him make we bring a senior hunter for this episode where answer questions like.
    • Wetin be airdrop and how dem dey work.
    • How you fit do your research to identify projects wey go do airdrop
    • Wetin you suppose do to dey qualified for a projects airdrop.
    • How to ensure say you go avoid hackers as you dey hunt for airdrop.
    This and more na im we discuss for dis episode, so if you dey curious and wan sabi how airdrop dey work. This episode na for you. Oya download and listen Enjoy this episode🎉Disclaimer - bewareNothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank youFollow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlourFollow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9zSubscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5wLearn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9SJoin us for telegram https://t.me/banklessafrica
    40 min
  • USDC Wahala, Silvergate kasala, make we talk stablecoins!

    Kasala burst for street between the 9th of March to the 13th of March as news enter street say USDC wey suppose be stable coin don dey shake and silicon valley bank shut down operations!.

    Fear meet everyone, FUD dey everywhere, dem talk say yawa don gas many people don put their live savings for this stable coin, this cry na him make us go bring this industry expert "Aisha" come pidgin Parlour crypto podcast make she come answer the many questions wey pipo dey ask us.

    So if you don dey ask say:

    • If you wan know wetin be stable coin and why dem create am, this episode na for you

    • How coin wey suppose stable come dey shake, our guest give us details about this

    • If you dey reason say, silicon Valley Bank Na senior Men Bank for America, how such whale fo fall.

    Our guest give answer to all this questions and more.

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us for telegram https://t.me/banklessafrica

    48 min
  • Blockchain don dey disrupt Health Sector : find out how!

    Na every day we dey see the massive change wey blockchain dey cause for our world today.

    He don dey clear say this innovation pass cryptocurrency alone, Im impact reach Medicine, Agriculture, Digital artistry and many sectors wey we no fit mention.

    For this episode our guest "divine gift" share with us how blockchain dey change the medical sector, the thing wey Im share for this episode go answer plenti questions wey dey your mind especially about the mata of record keeping in the health sector. You go learn how dem dey take blockchain dey take solve this issue and many others.

    You go get answer to questions like:

    • How dem fit apply blockchain to the health sector and wetin be the benefit

    • How you fit use blockchain for record keeping, data sharing and research for hospital

    • Wetin be the downside of this innovation.

    So, if you wan take your blockchain education and adventure to the next level, this episode na the real deal for you

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us for telegram https://t.me/banklessafrica

    33 min
  • Play to earn : Wetin you suppose to know with Marablossom

    Una don hear say blockchain no be cryptocurrency and cryptocurrency no be blockchain.

    The next question wey plenti people dey usually ask be say, if blockchain no be crypto, wetin dem fit use blockchain do again wey no be crypto?

    Make we shock you!!!!

    Dem don dey play game on top blockchain and this kain game dey different from wetin you don know, the real gist be say "as una dey play this one, you go dey make moni"

    Dem call am "play to earn". You dey ask wetin be this?. Na why we go carry Marablossom of Women in DeFi make Im come explain how and why dem create dis games.

    For this episode, we ansa questions like

    • Wetin be play 2 earn game model and how Im dey work?

    • Wetin be the advantages of this play to earn game models and how blockchain enthusiast fit take advantage of them.

    • If you wan start your play to earn adventure, wetin you suppose watch out for.

    So, if you wan take your blockchain education and adventure to the next level, this episode na the real deal for you

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow us for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join us for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us for telegram https://t.me/banklessafrica

    46 min
  • Tokens, Coins, altcoins, Shitcoins - Wetin be all these?

    E no dey possible make we desire say crypto suppose reach every corner for street and we no go go big on education…

    Just like una don sabi say, education na the concrete wey this web3 adoption go stand on, na him make we go bring one "Coin Lord" for this particular episode.

    Paulito, na O. G for this space especially wen im come to coin mata. So if una don dey ask say "Tokens, Coins, altcoins, Shitcoins - wetin be all these?.

    This episode go give you all the answers wey you need. We follow answer questions like:

    ♦️ Wetin be cryptocurrency and how Im dey take work?

    ♦️ We don hear about Coin, tokens and altcoin, dem be the same thing or dem different?

    ♦️How we dey sure say this cryptocurrency no go fade away, wetin make them valuable for the market?

    ♦️ If I be newbie and I Wan buy my first cryptocurrency, where I fit buy am.

    If you get any of this question for mind or una wan brush up wetin you don know, this episode na correct one for you.

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/banklessafrica

    43 min
  • Tori wey go jinja you for web3 w/ Carp_big

    Di secrets of pipo wey don make am dey inside dia tori, if you wan do wetin dem dey do, the best thing to do na to listen to their tori.

    On dis Pidgin Palour Crypto podcast episode we bin get deep conversation with di founder of Carp_ex. "Big carp" na 22 years old founder wey start im crypto journey wen im be 18 years old!!!

    Im tell us the problem wey im face as he dey start out, you see the way wey im tori take be go make you get hope for your mind.

    ♦️E tell us wetin carry am enta web3 space when he still dey school

    ♦️Why mentor dey important for your journey

    ♦️Di wahala wey im face wen im start im journey wen e be 18.

    ♦️And wetin e dey build now for di space.

    ♦️ Finally, im come tell us how anybody fit start OTC trading

    E be true say glory no dey without tori. Make you get inspiration as you listen to dis episode.

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/banklessafrica

    38 min
  • Wetin be Blockchain Trilemma and how dem dey try fix am

    Many pipo still never understand the mata of this blockchain wey we dey yarn, dem truly dey wonda why everybodi dey mention am for street and wetin dey be say, if dem no understand how this thing dey work, he go dey difficult make dem use am or tell their neighbor about this new technology.

    Na why for this particular episode of the Pidgin Palour podcast, we further go into details of :

    ♦️Wetin be blockchain and why dem create am?

    ♦️Dis blockchain get any problem so or na perfect technology?

    ♦️Wetin be blockchain trilemma?

    ♦️How Ethereum blockchain dey take solve this trilemma?

    ♦️How this merge wey Ethereum don do take affect their project and wetin other projects fit learn from them?

    Na this things and more wey we discuss for this episode, when you don finish listening to this episode, your confidence and knowledge for this space go don increase.

    Oya download and listen

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegramhttps://t.me/banklessafrica

    29 min
  • Protect Your Moni : Web3 security & wallet basics

    Security na one big matter for the world wey we dey today, everybodi dey find better way take protect their goods, possessions, loved ones and their assets.

    So, in don dey important make we talk about Web3 security and how person fit protect him identity and asset for this space.

    Na the koko of our gist for this particular episode be this, as our guest "salvi_cee" open our eye for the plenti ways pipo dey loose diar money for web3 and you fit avoid am.

    We cover ma like :

    Why him dey important make we talk about Web3 security?

    Wetin be digital wallet and how hin dey take work

    Wallet strategies person fit use stay SAFU and how you fit recover from scam if you Don fall victim before.

    Oya go download, listen and share give your family and friends because if anything happen for this to your asset for his, customer support no dey to call.

    Stay SAFU💯

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/banklessafrica

    38 min
  • Career Opportunities wey dey for Crypto/Web3📲

    Plenty people don dey shook eye inside web3 for this 2023 because say the news about the industry don dey sweet for the street.

    People bin ask us about whether e go possible to make strong career inside blockchain without buying or selling or coding? Na the question we don answer for today's show.

    My guest na today na one ogbonge web3 writer wey dey build correct career for this space and she share hin story gives us, how she started and wetin she don do to build hin career.

    She answer questions like - -

    ♦️Wetin be blockchain career?

    ♦️Wetin make person go choose this way?

    ♦️Examples of work wey dey inside blockchain?

    ♦️Jobs dey truly for crypto space?

    ♦️Where person go find these opportunities?

    ♦️Wetin person need to start?

    Go carry your sit, get Una pen because as you finish this episode, your eye go clear as you see say you Don dey leave plenty money for table.

    Enjoy🎉🎉

    Follow Pidgin Parlour for all platform

    Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn

    https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233

    Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour

    Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/banklessafrica

    49 min
  • Bull & Bear Market, wetin you for know!

    Person wey no understand how cryptocurrency dey work go think say the people wey dey win for the space just get luck.

    However, no be so he dey happen - - as many newbie dey always ask us say when the current bear market wey dey for street go finish?

    For this episode of the Pidgin Parlour Crypto podcast, we bring Mr Chiakwa - An OG for Technical and Fundamental Analysis wey answer many questions wey dey your mind on how you go remain profitable for any season for cryptocurrency.

    He follow us answer questions like:

    Wetin dey cause bear and bull season in cryptocurrency?

    Wetin be the best practices for investors in this seasons?

    As we dey bear season now, how we fit know when bull season go be?

    As market don red, wetin I suppose know to make money for this bear season?

    If you get any question concerning wetin go happen for the crypto space for 2023, this episode give you correct overview of wetin the market go talk.

    Listen and tell your frens say update don dey!

    Follow Pidgin Parlour for all platform

    Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn

    https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233

    Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour

    Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/banklessafrica

    41 min

About Pidgin Parlour Crypto Podcast

From the publisher's feed

Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey…