
Sign up to save your podcasts
Or


"Decentralized Finance (DeFi) na financial system wey dey operate on top decentralized network, like blockchain. DeFi wan provide financial services wey dey open, transparent, and accessible to everybody, no need for intermediaries like banks or financial institutions. DeFi allow users access financial services like borrowing, lending, trading, and payment processing directly on top blockchain, wey go allow dem interact with each other directly and without need for trust. DeFi get the potential to disrupt traditional financial systems and create financial system wey go include everybody."
Ever since FTX and many of the centralized finance platform show us shege through out this year, many people don dey remove their mind small small for Centralized Finance come Decentralized Finance because as you and I Sabi say nobody wan chop breakfast twice, na why we begin a new series this week for the Pidgin Palour Crypto podcast where we begin dey talk about Decentralized Finance.
For this episode, our guest na one ogbonge for the DEFI space, hin name na KING JOSH and he go teach us why decentralized finance dey important and how any newbie fit begin their journey for the space.
Nothing beta pass make you see person wey don dey trenches before wey come become big man because of web3 and DeFi share the tori of hin journey with you.
Na wetin King Josh do for this space be that, so jump on it and learn for yourself how you fit use DeFi make your life beta.
Hope say you enjoy this episode.
We beg, make you share, download, rate and leave review for hear so say we go fit make this podcast better. Thank you🫱🏾🫲🏾🎉😉
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
If you no know wetin dey happen for street, dem go carry wetin be your own give another person wey get street sense.
Na him be say dem don shop your eye free of charge.
Because, we no won make you be victim, na why we bring the Lady Hayley for this latest episode as she open eye for us intoto everything wey dey happen for crypto space.
All the way go the fall of "Terra, 3AC, Celsius and the latest kasala wey burst for street - - FTX debacle.
Our guest talk plenty tori upon this matter but I go just say a few point wey she talk…
The first thing wey she open our eye to be" why this evil befall this exchanges and how you fit avoid kasala in case of another time
She talk say hin be like say the crypto space need small regulation, because if regulation dey, all this founders no go dey misbehave.
She further talk say make people also learn to use "DEX" replace "CEX" because the wahala wey happen for "CEX" too much.
Our guest show us say SBF get bad belle because of wetin he dey take people money do through "Alameda". She further talk say no be from village dem do SBF o, na management problem do am.
Finally, she talk say if SBF get good relationship with CZ, fire for no burn SBF but as rivalry don enter amidst dem and CZ collect him money wey dey FTX the market shook and all the small small trader follow the Jagaban.
One wisdom she close with be say, relationship dey important for anything wey we dey do for this life.
hear this episode for full gist!
Follow Pidgin Parlour for all platform
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn
https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
For this episode, we dey feature Igwenagu Emmanuel Chinecherem, founder and CEO of Gentle Crypto. Gentle Crypto nah organization wey dey provide financial and crypto education and more.
Crypto no be just about trading and thinking of making quick money! It's about understanding wetin the technology be for and how best you fit adopt am and thrive in chaotic times.
Emmanuel talk about him journey into the world of crypto and how e don grow to appreciate the technology since joining.
Emmanuel talk say after them scam am plenty plenty for so called crypto investment platform, him don tire for inside crypto space him come decide to dey run things by himself and nah wetin make am start Gentle crypto, so that him go fit help other people avoid the kind shege wey him see for inside the crypto space.
Hin talk say him motivation na say him don get strong mind about crypto via all the knowledge wey him don gather and whether bear or bull market him no go shake. Hin talk say hin dey tell people say if you go survive for inside the crypto space you gats get strong mind. Whether you win or lose always dey positive.
The advantage and disadvantage wey dey for buying crypto dey depend on when you buy am if you buy am when e dey low you get high chances to dey on profit for long, if you buy when e dey high, you go dey patience to gain. Emmanuel drop plenty practices for this episode inside wey go fit help everyone survive and thrive for crypto inside.
Enjoy 💯🎊✌🏾
If you enjoy the episode; no forget to download am, rate us and share with your people dem.
The Pidgin Parlor crypto show dey educate the everyday African on Web3 and crypto topics, dey yarn them the latest updates and tori for the crypto ecosystem, dey highlight projects, ecosystems and man dem wey dey impact and drive the crypto adoption for these African streets. The Pidgin Parlor Crypto Podcast na your plug if you wan dey informed on all things wey concern Bitcoin, DeFi, NFTs, Web3 and others, even as it take dey enter streets inside!
Disclaimer:
Nothing wey anybody talk for this show na financial advice. Every man wey come talk for this show just dey come yarn hin own opinions. Remember say the number one rule for this Web3 street na to run your own research!
Make we connect💯💯🎊
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlour
Follow us on linkedIn https://tinyurl.com/yzjwjd53
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Na interview with Paulito for this episode sha.Paulito na BanklessDAO/Bankless Africa contributor, hin dey crypto space for long, wey hin gather plenty experience for huge crypto organizations like Revewz and DIA.
edey well known say even people wey don dey inside Web3 and crypto street no too dey understand cryptocurrencies. Paulito for this interview, yarn us for pidgin wey be say people wey dey streets and all man wey sabi speak pidgin go understand wetin blockchain technology be, how dem take arrange(build) am, how it take dey work and how this blockchain technology take dey power crypto.
If you enjoy the episode; no forget to download am, rate us and share with your people dem.
The Pidgin Parlor crypto show dey educate the average African on Web3 and crypto topics, dey yarn them the latest updates and tori for the crypto ecosystem, dey highlight projects, ecosystems and man dem wey dey impact and drive the crypto adoption for these African streets. The Pidgin Parlor Crypto Podcast na your plug if you wan dey informed on all things wey concern Bitcoin, DeFi, NFTs, Web3 and others, even as it take dey enter streets inside!
Disclaimer:
Nothing wey anybody talk for this show na financial advice. Every man wey come talk for this show just dey come yarn hin own opinions. Remember say the number one rule for this Web3 street na to run your own research!
Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233 Join us on telegram https://t.me/banklessafrica
Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour
Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Crypto don dey change many lives around the world, but how many of our own African people dey get proper education and updates about this crypto level wey, everybody, don dey yarn?
Na with this fact in mind why Bankless Africa dey introduce the Pidgin Parlor Crypto podcast.
Podcast wey we go dey gather talk all things crypto and web3 so our listeners and everyday Africans for street no go carry last.
For every episode, Pidgin Parlor Crypto Podcast go dey sama una with latest crypto tori, updates, and interviews with ogs dem for inside this crypto space.
So make una dey anticipate as Pidgin Parlor Crypto Podcast go carry una on a crypto journey wey una no go ever forget.DisclaimerBut make una know say nothing wey we go yarn for any episode of the pidgin parlor podcast be financial advise. Make una always run una own research.Pidgin Parlour Crypto Podcast na Bankless Africa podcast we dey bring crypto/web3 education and culture to over 75 million pidgin speakers in and outside Africa.
From the publisher's feed