Pidgin Parlour Crypto Podcast

Pidgin Parlour Crypto Podcast

By Pidgin ParlourEducation
Download on the App Store

Pidgin Parlour Crypto Podcast episodes

  • Gada for here, make we reason African Bitcoiners!

    E be like say , if we talk about cryptocurrency pipe wey be Bitcoiners Dey always reason say, na only them be di correct crypto pipo, say all of una dey play.

    For dis episode , we invite person wey be OG for di African bitcoin space make em tell us why dem Dey reason like that.

    If dis mata concern una, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    48 min
  • Why dem put parvel durov inside prison? (Wetin una suppose sabi)

    Why dem carry parvel durov enter prison na Wetin everi body Dey shout be dat.

    some pipo talk say na because government dey beef am for privacy policy , odas talk say na bad pesin

    inside dis episode, we gada reason why dis mata dey sup.

    If dis mata concern una, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    6 min
  • Wetin dey sup on top TON blockchain.

    If una check wetin dey sup for di crypto space una go realize say many projects, Dapps, & blockchain just dey surface for dis bullrun.

    Out of many tinz wey don sup, TON blockchain dey show beta swag for dis season, as e dey rise, many Pipo dey come build on top di blockchain.

    For dis episode we gada explore wetin be ton blockchain and why im dey get beta attention for dis season.

    If dis mata concern una, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    25 min
  • Wetin go sup for Crypto if Kamala Harris enter Office?

    As una don know say U. S election dey always matter inside di crypto market and Donald Trump na di only person wey don show say e dey gidigba for di crypto market.

    But as una don dey watch Joe Biden don step down take power give Kamala Harris, di question go come bi, wetin Kamala go do, Im go follow trump path or Biden way.

    We no go know until we know wetin sup for inside dis episode.

    If dis mata concern una, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    22 min
  • How you fit DYOR for dis bull run

    As bull run don show, mani pipo go like shook head for inside the crypto market becos plenty opportunity don come, however as una dey plan to make moni, na so scammer dey also plan to scam mani Pipo.

    Na why e better make una sabi di tinz wey you suppose know for di market and una fit DYOR so una no go shook your leg inside scammer trap.

    For dis episode we gada talk:

    1.)Wetin be bull run

    2.)Di first tin wey you suppose sabi if you go shook your moni inside any project.

    3.) How you fit DYOR and ape in correctly.

    4.)Di tools wey you go need to do well.

    If dis mata interest you, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    29 min
  • Wetin be Bitcoin ETF?

    Real world Assets

    Who go believe say dem go ever approve ETF for di crypto space, dis mata go loud!. 

    As you don hear say dem don approve BITCOIN ETF, e just be like say dem dey cap cause ETF na mata wey dey popular with Stock, bond, and other investment fund and no be Crypto. 

    However, as dem don approve dis model, everibodi dey happy because e mean say plenti Pipo go like shook mouth for inside crypto. 

    For dis episode we gada talk:

    • Wetin ETF be
    • How di approval go affect di market. 
    • Wetin bi di advantages & disadvantages. 

    If dis mata interest you, make una download and listen. 

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour 

    19 min
  • Pidgin parlour New year Jamz

    Happy new year all of na wey dey follow us for Africa and we dey happy say all of una don enter 2024 and you dey kampe.

    As our culture be for pidgin parlor we go like give una update for everything wey we do for 2023 and wetin you suppose expect for di new year.

    So make una sit down as we gada reason wetin dey happen for pidgin parlour.

    Oya download, make una listen and give your Pipo too.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    35 min
  • How NFT go be for bull run?

    How pesin go pay $1million for pictures, wey una fit just carry anywhere?

    Na wetin layman dey ask be dat when dem hear about NFT, so today we wan check wetin be NFT and how una fit profit from dis mata in crypto.

    We don go carry Arrow come studio today as Im dey give us NFT alpha for dis episode

    For dis episode, una go understand.

    • Wetin be NFT
    • How dis images dey operate
    • How una fit profit from NFT
    • Wetin be di future of NFT

    If dis mata interest you, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram

    https://t.me/pidginparlour

    30 min
  • ReFi dey change di World, Una don hear?

    ReFi, wey oyinbo Pipo dey call Regenerative Finance, dey change di world. Dis one no be lie o, na correct matter.

    Many Pipo wey dey web3 dey do DeFi, Desci, NFT, Degen, but only small % dey reason ReFi…

    Di reason be say ReFi no dey run as others dey behave, but as una go dey hear for dis episode ReFi dey change Pipo life and many Pipo no even sabi…

    Na why I call one maxi wey dey di ReFi space make Im come tell us about am.

    For dis episode, una go learn…

    • Wetin be ReFi
    • How ReFi take different from Public Good.
    • How we fit get more Pipo wey dey DeFi to dey reason ReFi.
    • Di Challenges wey dey ReFi and how una go fit manage am.

    If dis mata interest you, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram

    https://t.me/pidginparlour

    51 min
  • Asset wey dey real life (Real World Asset), wetin dem be?

    If you no know, Pipo wey dey outside web3 don dey shook dia moni inside di market now…

    As everywhere don dey green small small, one question wey una dey ask be say where all dis moni dey come from…

    Na where Assets wey dey for correct world(Real World Asset) show face be that.

    Dem dey give Pipo wey dey outside web3 chance to shook dia money inside di market. Una dey feel di gist Che?

    So for dis episode we gather reason.

    • Wetin be Real world Assets
    • Wetin dem fit tokenize…
    • How una fit make moni from dis narrative.
    • Wetin be di future of this narrative in di crypto space.

    If dis mata interest you, make una download and listen.

    Enjoy this episode🎉

    Disclaimer - beware

    Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well.

    Thank you

    Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour

    Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z

    Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w

    Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/

    Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

    Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

    35 min

About Pidgin Parlour Crypto Podcast

From the publisher's feed

Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey…