Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.
September 13, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa pikin dem as dem go stat skool, for God to give papa and mama moni,for ticha and odar pipo for skool.De message of Hope dey tell us say praya na make we forlow God tork as we dey forlow hawa friend tork....more29minPlay
September 12, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song say hawa fait dey look Jesus and de sekond song say na fait naim we take reach whey we dey now and naim we take forlow God waka.De message of Hope say make we put God word for hawa hat so dat hawa fait go grow and hawa fait go strong....more29minPlay
September 11, 2026Kweshun and Ansa - God word wen we dey take growDe kweshun of watin pesin go do wen de pipo wen hin do good for bifor come dey do am bad now bikos e no get moni again naim bi today mata.Today message of Hope say if hawa praya no get fait God no go fit ansa de praya....more29minPlay
September 10, 2026Family mata - God word wen we dey take growToday we see say Abram go fite war so dat e go fit save Lot and hin propati, make we sef learn to dey epp hawa pipo.De message of Hope say we musto put fait for hawa praya and we no go get two mind if we tru-tru want make God ansa hawa praya...more29minPlay
September 09, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growToday sikness na lassa feva, one sikness wen dey dey hinside rat shit and piss and wen pesin fit get if rat piss or shit torsh food, plate or odar tins.De message of Hope say fait na hawa bullet proof wen we dey forlow devo fite...more29minPlay
September 08, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen dey make pikin and odar pipo dey get long troat naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na fait we dey take win de fite wen devo dey forlow us fite and even de fite wen we dey fite to commot for sin....more29minPlay
September 07, 2026Family mata - God word wen we dey take growWen we want build trust again for marrage we must redi to tork de trut so dat de pesin wen dey vex go know how e go take forgive us.Today message of Hope dey show us pipo for bybbo wen get fait wen we go fit forlow deir esampo and do as dem do....more29minPlay
September 06, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for de tins dem wen una say make we pray for and we pray for fama wen fulani scata deir farm and pipo wen want make God heal dem.De message of Hope dey tell us say we must get fait if we tru-tru wan forlow God waka....more29minPlay
September 05, 2026Praise - God word wen we dey take growToday two song na de same song wen differen pipo sing and de message na say e no go tay again, Jesus go come.De message of Hope say make we stand strong make we no let hawa fait die bikos Jesus go come e no go tay again....more29minPlay
September 04, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen Jesus want make we know for hinside Matthew 6:33 naim bi de kweshun wen we ansa today.Today message of Hope say wen Jesus come evrybodi go see am, hin coe no go bi sekrit mata and e go take us go hin kindom....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.