Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.
August 10, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda tin wen go make trust fit dey for marrage na say make pipo get respet for watin deir patina want.De message of Hope dey tell us say we no go fit get de life wen no dey end wen God wan give us onless we bi pipo wen dey do watin God tork....more29minPlay
August 09, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa soja dem make God give dem korret sense make dem know as dem go take win bandit dem for de fite.De message of Hope dey tell us de kain pesin wen God want make we bi for dis world....more29minPlay
August 08, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song na praya make God give us klin hat and de sekond song na anoda praya make God put us for whey hin dey.De message of Hope say God dey make hawa life new evryday and we too go waka for de new life wen God give us....more29minPlay
August 07, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen want bi beta woman must be woman wen hin yes na yes and wen get watin e dey do with hin life wen e go fit take manage hin life.Today message of Hope say we dey de world but we no sorpose bi like de world pipo so make we no put hawa hand for sin...more29minPlay
August 06, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda lesin for Noah life bi say make we as papa and mama no do enitin wen go bring wahala come hawa family and hawa piin life.Today message of Hope say make we no forlow de world and make we no like de tins wen dey de world...more29minPlay
August 05, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growWatin make us sorpose dey sleep well well and to make sure say we dey sleep well naim bi today mata.Today message of Hope say make we put God fess for hawa life and make we no let hawa long troat make us do watin God no want....more29minPlay
August 04, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe kain tin wen dey happun wen pikin learn bad tin from hin friend dem naim bi today mata.Today message of Hope say God want make we take hawa cross and forlow Jesus and make hawa life bi living sacrifice....more29minPlay
August 03, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda tin we go do to take get trust for marrage na make we no dey gree for evrytin, make we tork no if we no want sometin.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen give Jesus hin life and e no dey do enitin wen God no want...more29minPlay
August 02, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God epp us bring Nathan, Leah Shaibu and all odar pipo wen still dey kidnapa hand.De message of Hope say God get merci and God want make hin pikin dem dey show pipo merci for dis life....more29minPlay
August 01, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song say make we carri God word eni whey we dey go and de sekond song say God word dey make us well if we sik.De message of Hope say God word naim bi de sord wen we dey take fite all de fite wen we dey fite with devo....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.