Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.
July 16, 2026Family mata - God word wen we dey take growMake wife dem no join deir husband for bad tin naim bi anoda lesin wen we learn for Adam and Eve stori today.De message of Hope say na de Holy Spirit dey fit make us resembo Jesus wen we go take dey do beta tin wen God like...more29minPlay
July 15, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growSome odar tin wen fit make pesin get bress kansa and some sign wen go dey de bodi naim bi today tork.De message of Hope dey tell us de tiree beta work wen de Holy Spirit dey do for hawa life wen we let am enta hawa life....more29minPlay
July 14, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen fit make pikin dey carri tork and no dey respet odar pipo naim bi today mata,Today message of Hope say de Holy Spirit na de Spirit of Truth, e no dey tork lie and eni pesin wen get Holy Spirit no go dey lie....more29minPlay
July 13, 2026Family mata - God word wen we dey take growTrust no just dey happun, e dey take time to build am and na as pesin dey do watin e tork naim dem dey take trust am.Today message of Hope say de Holy Spirit na anoda epper wen God send come after Jesus go so dat e go epp us as Jesus epp us....more29minPlay
July 12, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for all hawa farma dem make God for let deir farm grow well so dat food go dey kontree.De message of Hope dey tell us say de Holy Spirit no bi breeze but na pesinality like God and Jesus...more29minPlay
July 11, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song na make Jesus give us hin kain hat and de sekond song say make we pursue God kindom fess.De message of Hope say to maintain hawa pawa we must kontinue to pray, read hawa bybbo, do watin God tork and tell odar pipo abat Jesus...more29minPlay
July 10, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growGod want make we bi like salt for hawa life so dat we go make pipo like beta with hawa karacta and evrytin wen we getToday message of Hope dey tell us as we go take forlow God waka afta we don give Jesus hawa life and we don baptise...more29minPlay
July 09, 2026Family mata - God word wen we dey take growToday lesin we we take from Adam and Eve na say make husband dey cova and protect hin wife wen wahala dey.De message of Hope say God pawa go dey hawa life if we dey do good good tin like Jesus Christ do wen e come dis world....more29minPlay
July 08, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain pipo wen fit get bress kansa and de kain test wen pesin fit do make e for kwik know if kansa enta hin bodi nain bi today mata.Today message of Hope say de numba four tin we must do to take get God pawa for hawa life na make we dey go shurch...more29minPlay
July 07, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growWen pikin and even old pipo no get respet, wen dem dey tork enihow na rudeness and nain bi today mata.Today message of Hope say wen we praise God, God go give us pawa like Paul and Silas praise God for prison and de prison door open...more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.