Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.
June 26, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen get beta strong fait for hinside God and e sabi carri all hin wahala give God, dat woman go bi happi woman.Today message of Hope na God Law naim dey make devo no fit take sin tie hawa leg and hand bikos who obey de law no dey go prison...more29minPlay
June 23, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growToday mata konsign pesin wen sorpose do sometin and e no do de tin de time wen e sorpose do am.De message of Hope say God law dey bifor God write am give Moses, bikos na whey law dey we dey see sin and sin dey bifor dem born Moses....more29minPlay
June 22, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda sekrit wen family dey get na wen pesin rape girl pikin for de family bikos rape dey spoil pesin name.Today message of Hope say God give us mani law but de ogbonge one and de 10 commandment wen God take hin own finga write....more29minPlay
June 21, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa pikin dem make God for kip dem and make dem no die premashure die.De message of Hope dey tell us say God law wen bi de ten commandment na sometin wen all of us sorpose dey obey if we tru-tru love God...more29minPlay
June 20, 2026Praise - God word wen we dey take growHawa fess song say make we give Jesus all hawa wahala and de sekond song say God go fit do am again. Today message of Hope say God don tell us how we go take waka for dis life hinside wahala so make we hear watin God word dey tell us and do am...more29minPlay
June 19, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen sabi commot vexnation for mind and e dey forgive na woman wen go bi happi woman.Today message of God say God want make we faithful hinside all de wahala wen we dey bikos Jesus go give us crown wen e come....more29minPlay
June 18, 2026Family mata - God word wen we dey take growMake woman marray man wen put Gd word for hin hat, wen carri Jesus mata for head and wen no dey forlow hin kulshure and tradishunDe message of Hope say wen we faitful if wen devo kill us bikos of hawa fait God go give us crown wen Jesus come again....more29minPlay
June 17, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain tin wen fit make pesin get sor for hinside hin belle and watin pesin fit do for de mata naim bi today torkToday message of Hope say wen hawa eye see beta wahala make we rememba say Jesus sef see wahala and evry wahala get de day e go end...more29minPlay
June 16, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growAnoda bad tin for dis exam mata na wen one pesin take anoda pesin name take write exam and dis one fit make pesin go prison.Today message of Hope say wen wahala full hawa life make we know say na devo dey wan scatar hawa fait so make we no gree for devo....more29minPlay
June 15, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda sekrit wen family dey get na sikness for de family but dis kain sekirt no good bikos e fit bring plenti wahala come de family.Today message of Hope say wen we dey for wahala make we rememba say God no dey forget hin pipo and e go save we....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.