Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.
July 06, 2026Family mata - God word wen we dey take growTrust, wen bi de strong mind wen pipo dey get for itsh odar na sometin wen sorpose dey for marrage and de way we go take get am naim bi today mata.Today message of Hope say de sekond tin we must get to take get God kain pawa na praya...more29minPlay
July 05, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for pipo wen dey sick differen kain sikness make God torsh dem make dem well.De message of Hope say pesin wen wan get de pawa wen God dey give must bi pesin wen know God word and e dey do watin God tork....more29minPlay
July 04, 2026Praise - God word wen we dey take growToday two songs dey tell us say Jesus wen bi de light for world don make us light so make we let hawa light shine.De message of Hope say God don tell us say darkness go dey but God too don make us light so make we shine make pipo for see Jesus....more29minPlay
July 03, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen get God for hin life and wen sabi forlow God waka na happi woman bikos God word naim dey kip hawa life.Today message of Hope say make we win de fite wen devo dey fite us with sin and bad karacta and we go get God white cloth...more29minPlay
July 02, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda lesin wen we learn from Adam and Eve bi say make woman no give hin husband watin fit kill am and make man sef no just dey forlow hin wife enihow.Today message of Hope say make we no let sin stain hawa white dress wen God give us....more29minPlay
July 01, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growWatin bress kansa bi and de kain pipo wen go fit get am naim bi today mata.Today message of Hope say God don give us hin white cloth wen bi hin righteousness so make we waka as Enoch forlow God waka and commot bodi for sin....more29minPlay
June 30, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growFear na one big tin wen no dey let pipo do watin dem sorpose do wen dem sorpose do de tin so make we commot fear from bodi.Today message of Hope say make we get strong mind, make we believe and trust God and God go epp us as e epp Gideon for bybbo...more29minPlay
June 29, 2026Family mata - God word wen we dey take growMake man no take work wen e no get bikos dem sack am take do sekrit for family.Today message of Hope say make we no let enitin stop us from de good wen we dey do bikos God dey see us and e know how to bless us...more29minPlay
June 28, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for de komuniti dem wen dey fite demsef and de pikin dem and ticha wen kidnapa carri from Oyo skoolDe message of Hope say no mata watin we see for dis life make we hold God word and hin hand and make we no give up...more29minPlay
June 27, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song na de hymn "Give me de Bybbo" and de sekond song dey tell us watin God law bi.De message of Hope say pipo wen obey God law dey get plenti yanfu-yanfu blessing wen dem no go fit count....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.