Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.
May 25, 2026Family mata - God word wen we dey take growDe way wen bitaness take dey scatar de waka wen we dey forlow God waka naim bi today mata.Today message of Hope say even Rehab wen bi ashawo con know God and na so hin life take change and God sef redi to change yor life today....more29minPlay
May 24, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for Kebbi State, make God epp make all de wahala wen dey happun for deir stop.De message of Hope say na pesin wen chop food know say e sweet so na only as we gie Jesus hawa life we go know say God na good God....more29minPlay
May 23, 2026Praise - God word wen we dey take growToday two songs dey tell us say God dey ansa praya and e go ansa hawa praya so make we pray.De message of Hope say make we put thanksgiving and praise for hawa praya bikos God dey tru-tru ansa praya....more29minPlay
May 22, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growWoman wen sabi chop well, sleep well, get friend wen e dey forlow put stori and know God as hin papa na happi womanDe message of Hope say wen we pray make we humbo and make we no get enimi wen we no fit forgive and God go ansa hawa praya...more29minPlay
May 21, 2026Family mata - God word wen we dey take growMan wen sabi trust pesin and wen dey forlow God, dey do watin God want and love God with all hin hat na beta man to marry.De message of Hope tell us say make we pray from de bottom of hawa hat, make we get patience and make we no give up and God go ansa....more29minPlay
May 20, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growWatin dey make pipo faint and watin we go do wen pesin faint naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say praya get pawa bikos na God naim say make we pray and wen we pray God go ansa hawa praya....more29minPlay
May 19, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen pikin sorpose know wen e go do wen e dey rite exam so dat e go pass de exam naim bi today tork.Today message of Hope tell us watin we go do as we dey pray wen God make God ansa hawa praya shap-shap....more29minPlay
May 18, 2026Family mata - God word wen we dey take growAll de planti sikness wen bitaness dey put for pesin bodi naim bi today mata so e go beta make we forgive.Today message of Hope dey tell us say Jesus hinsef give us de style wen we go take pray praya so dat God go ansa us....more29minPlay
May 17, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God save all de pipo wen still dey kidnapa hand and make e scatar kidnapa business for hawa kontree.De message of Hope say praya na sometin wen pesin wen say hin bi kristian musto do bekos naim we take dey forlow God tork....more29minPlay
May 16, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song say we no good but Jesus make us hin friend and de sekond song say make we trust and obey God.De message of Hope show us de kain pipo wen God dey give hin merci and if we waka as dem waka we go get God merci....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.