Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.
May 04, 2026Family mata - God word wen we dey take growDe tin wen bitaness go make happun for pesin bodi as de bitaness dey tay for bodi naim bi today mata.Today message of Hope say for pesin to tru-tru dey hinside Jesus, de pesin musto sabi pray as Jesus tish us for bybbo....more29minPlay
May 03, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God epp us bring all de pipo wen dey kidnapa dem hand and make God save dem.De message of Hope say God want make we dey hinside Jesus Christ de way wen branch dey hinside tree....more29minPlay
May 02, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess son let us know say no bi bikos we good make Jesus save we and de sekond song say God love na ogbonge love.De message of Hope dey tell us say God give us de sabbat for rest and even wen we rish heaven we go still rest for de sabbat....more29minPlay
May 01, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growHappi woman na woman wen get pawa to take do de tins dem wen e sorpose do as woman for hinsef and hin family.Today message of Hope say na Jesus naim die wen make us fit commot for devo hand and for sin and Jesus dey heaven dey pray for we....more29minPlay
April 30, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda tin wen man go see for de woman wen e want marray wen go let am know say na de woman be dat naim we go tork today.Today message of Hope say God give Israel rest wen dem come out of Egypt and God dey plan hawa rest wen Jesus come again....more29minPlay
April 29, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe sikness wen dey let pesin belle dey do wan kain and wen pesin no go fit shit well naim we still put mout today.Today message of Hope tell us as God take save Israel commot for Egypt and e give dem hin law so dat dem go do watin e want...more29minPlay
April 28, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growWatin examinashun bi and why for hawa life we musto dey do examinashun naim bi today mata.Today message of Hope say Abraham na pesin wen believe all de tin wen God tell am and dat one make am do watin God tork and God bless am...more29minPlay
April 27, 2026Family mata - God word wen we dey take growTiTVexnation wen pesin hold kakaraka for belle naim deyton to bitaness and bitaness fit scata marrage.Today message of Hope dey tell us say even for de time wen Noah dey life, God get plan wen e take save pipo bifor warta kill de odar pipo...more29minPlay
April 26, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for God to take moni bless hawa family, give pipo wen dey work promoshun and give hawa pikin dem work.De message of Hope dey tell us say God plan to save pipo dey ground bifor Adam and Eve sin sef so make we trust God....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,404 episodes available.