Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,407 episodes available.
March 09, 2026Family mata - God word wen we dey take growDe work wen God give husband dem wen dem sorpose do for deir family naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na for hinside Jesus Christ naim we go get de savashun wen God don give all of us....more29minPlay
March 08, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for all de pipo wen dey listin for hawa program and wen dey epp odar pipo dey listin to de program for deir ariaDe message of Hope dey tell us watin dis savashun wen God give us bi and how e dey commot us from sin and make God hawa papa...more29minPlay
March 07, 2026Praise - God word wen we dey take growToday two song dem dey tell us say wen Jesus dey hawa life we go get peace wen only Jesus dey give hin pipoDe message of Hope say Jesus peace na peace wen wahala no dey fit shake and na dat peace Jesus dey give hin pipo....more29minPlay
March 06, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growDe kain sense wen woman go take manage hin inlaw dem wen e no kwik born for de family and wen moni mata change naim bi today mata.Today message of Hope say hawa bodi na God house so make we no dey take hawa bodi do yama-yama tins....more29minPlay
March 05, 2026Family mata - God word wen we dey take growWen husband and wife buy propati like land, make dem write dem two name for de land paper so dat family pipo no go korlet de land.Today message of Hope say make we get fait bikos na only fait we go fit take forlow God waka and make God happi....more29minPlay
March 04, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growShikin pos sikness and watin pesin go see for bodi wen e go take know say e get shikin pos naim bi today mataToday message of Hope say make we bi beta care taker for God eye bikos wen Jesus come e go ask us watin we take hin blessing do for am...more29minPlay
March 03, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growTo forgive pesin wen do you bad dey hard but God want make we forgive bikos wen we no forgive odar pipo den God sef no go fit forgive us.De message of Hope say we get new life for hinside Jesus and God want make we holy for hinside de new life....more29minPlay
March 02, 2026Family mata - God word wen we dey take growDe lass tin for how to train hawa pikin well na say make hawa mind setto and calm so dat we go fit tell dem watin good for demToday message of Hope say God no want make we carri-tork for hin house so enitin we promise God make we do am....more29minPlay
March 01, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for pipo wen dey sick, de one wen dey smoke igbo make God make dem well and make God bless hawa muslim pipo.De message of Hope say make we take time dey read hawa bybbo and pray so dat we gofit get holi life...more29minPlay
February 28, 2026Praise - God word wen we dey take growToday two song dey tell us say make we trust God bikos God no dey change and God know pass we.De message of Hope say make we no fear, make we no doubt God but make we believe bikos God na tork and do....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,407 episodes available.