Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,407 episodes available.
February 27, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen dey make some inlaw forlow deir pikin wife get wahala afta deir marrage naim bi today mata.Today message of Hope say God want make we hold hin word for hawa hat, make we believe and make we no dey give up bikos God na tork and do...more29minPlay
February 26, 2026Family mata - God word wen we dey take growMake husband and wife plan how dem go take manage deir moni togeda take do de tins wen dem plan to do for deir family.Today message of Hope say God no dey forget hin pipo and e no dey leave us as e no leave Daniel dem for Babylon...more29minPlay
February 25, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe sikness wen konsign bad blood wen papa and mama dey give deir pikin and watin we go do to take manage de sikness naim bi today mata.Today message of Hope say God na tork and do and enitin wen God promise, God dey do am as e tork am....more29minPlay
February 24, 2026Pikin dem mata - God word wen we dey take growPikshure and film wen naked pipo dey and wen man and woman for de sleep togeda no bi sometin wen pikin sorpose put hin eye bikos e dey spoil mind.De message of Hope say God dey do watin e tork so make we read hawa bybbo to know God promise for hawa life...more29minPlay
February 23, 2026Family mata - God word wen we dey take growAnoda beta way to take train pikin na make we dey give dem de kain pornishment wen go make dem tink well.Today message of Hope say God want make we get fait bikos na only faith we go fit take forlow God waka....more29minPlay
February 22, 2026Praya - God word wen we dey take growToday praya na for de gorvament and pipo for Ondo, Ogun, Osun, and some odar state make God give dem sense to make deir state beta.De message of Hope say God word get pawa and na God word naim God take make dis world so make we believe God word....more29minPlay
February 21, 2026Praise - God word wen we dey take growToday fess song say Jesus na hawa gento shephad and de sekond song say we fit rest for God evalasting hand.De message of Hope say God dey protect hin pipo so dat notin go happun for dem and dat naim bi one way wen God take de care for hin pipo...more29minPlay
February 20, 2026Woman dem mata - God word wen we dey take growDe kain tin wen inlaw dem especially moda in law dey do deir pikin wife naim bi today mata.Today message of Hope say God dey give hin pipo rest na watin make am give us de sabbat so day we no go work no rest...more29minPlay
February 19, 2026Family mata - God word wen we dey take growMoni mata na sometin wen husband and wife go arrange if dem want make deir marrage sweet for de year.De message of Hope say God no want make we fear bikos of de way wen life bi now but e want make we get strong main bikos Jesus dey hawa korna...more29minPlay
February 18, 2026Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain tin wen vexnation fit do for pesin bodi and watin we go do wen we no go dey vex enihow naim bi today mata.Today message of Hope say wen e bi like say hawa life spoil and mata fall press us, God know how to take change hawa stori....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,407 episodes available.