Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.
October 12, 2025Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa govment, hawa pikin dem wen dey go serve govment and for hawa family to get moni.De message of Hope dey tell us say God word get gidigba pawa and na God word e take make dis world wen we dey so...more29minPlay
October 11, 2025Praise - God word wen we dey take growToday fess song say we don free as we dey hinside Jesus and de sekond song say God good.De message of Hope say wen we do watin God tork for hin law, we go get peace and plenti beta blessing dem....more29minPlay
October 10, 2025Woman dem mata - God word wen we dey take growDe kain tin wen mama sorpose forllow hin pikin wen get work dey do wen de pikin go take waka well naim bi today mata.Today message of Hope say na sin dey make us slave but wen we do watin God law say make we do we go free....more29minPlay
October 09, 2025Family mata - God word wen we dey take growAnoda kain bad husband or wife na dat one wen dey dey for fone from morning go rish nite and de one wen get bad mout.Today message of Hope say God law na mirror wen dey show us sin but de law no go fit save eni bodi....more29minPlay
October 08, 2025Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe tin wen pesin sorpose do wen e no go take get dis skrash bodi sikness and how to take commot am for bodi naim bi today mataToday message of Hope dey tell us God law wen dem nail for de cross wen don end and why dem nail de law for de cross....more29minPlay
October 07, 2025Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe kain fren wen pikin sorpose get as e dey waka for dis life wen go make am waka well naim bi today mata.Today message of Hope say God Law don dey from Heaven and as God make Adam and Eve, e give dem law too....more29minPlay
October 06, 2025Family mata - God word wen we dey take growDe mata wem konsign dat papa wen no dey hin pikin life and wen no dey do watin e sorpose do as papa naim we still dey tork.Today message of Hope say some law wen God give us don end but God 10 kormandment na one gidigba law wen no go end...more29minPlay
October 05, 2025Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa kontree make God put hand make strike no dey and make govament do watin dem sorpose do make kontree beta.De message of Hope dey tell us say God law still dey gidigba, e no go eva die bikos de God wen give de law no dey die....more29minPlay
October 04, 2025Praise - God word wen we dey take growToday fess song na "To be pleasing you" and de sekond song say God grace big pass all hawa sin.De message of Hope dey tell us watin go happun for pipo wen no dey do watin God tork for hin law and dey commit sin....more29minPlay
October 03, 2025Woman dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen mama sorpose do for hin pikin wen don come from NYSC and e neva get work and dey hinside house.Today message of Hope dey tell us say na God law dey let us know who hawa God bi and de kain life wen God want make we get....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.