Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.
June 13, 2025Woman dem mata - God word wen we dey take growMake papa and mama train deir boy pikin make e know say na hi God take do kartaka so make e do well make God fit tell am weldon.De message of Hope say make we serve God like Mary wen come bi de fess pesin wen see Jesus wen Jesus get up from grave....more29minPlay
June 12, 2025Family mata - God word wen we dey take growDe tin dem wen husband and wife go fit do to take make trust enta deir marrage again naim bi today advise.Today message of Hope say make we bi like Mary wen forlow Jesus waka go de cross and hin grave, e no run commot like Jesus discipo dem....more29minPlay
June 11, 2025Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe way wen pesin go take manage stress dat wahala wen fit carri odar sikness come your bodi naim bi today tork.Today message of Hope say make we bi like Mary wen save plenti mony take buy pafum tay rob Jesus bodi and Jesus praise am for watin e do...more29minPlay
June 10, 2025Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe tin dem wen hawa pikin dem go fit do to take get sef kontro for deir life naim bi today mata.Today message of Hope say as Jesus dey bring Lazarus wen don die come life na so e fit bring enitin wen don die for hawa life come back to life...more29minPlay
June 09, 2025Family mata - God word wen we dey take growSmall small tin dem wen husband and wife go do togeda wen deir marrage go take go front and sweet naim bi today mata.De message of Hope say make we bi like Mary wen dey siddon dey put ear for de tin wen Jesus dey tork....more29minPlay
June 08, 2025Praya - God word wen we dey take growToday praya na make God for epp all family dem make marrage for no scatar and make God kiore man dem wen dey marray man.De message of Hope say Jesus no dey kondem sinna but e dey give dem sekond chance to change and forlow God....more29minPlay
June 07, 2025Praise - God word wen we dey take growToday fess song na praya say make Jesus hold hawa hand and de sekond song say make we no de fite but make we dey togeda.De message of Hope say make we get strong fait make we no let enitin commot hawa eye from God bikos God dey hawa side...more29minPlay
June 06, 2025Woman dem mata - God word wen we dey take growAnoda kain work wen papa and mama go epp deir pikin learn na work wen dem dey take brain and sense take do.Today message of Hope say pesin wen bi beta kristian musto sabi tell odar pipo abat Jesus bikos dat na sometin wen God say make we do...more29minPlay
June 05, 2025Family mata - God word wen we dey take growDe way wen husband and wife go take trust demsef and forgive itsh odar even wen one pesin make mistake forlow anoda man or woman.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen give Jesus hin life and e dey go shursh with odar pipo wen bi God pikin...more29minPlay
June 04, 2025Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe way wen de wahala wen dey bring odar sikness come bodi take dey do small pikin dem and how papa and mama go take know naim bi today mata.Today message of Hope say beta kristian musto bi pesin wen dey pray as Jesus pray....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,409 episodes available.