Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.
July 24, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain sikness wen pesin fit get wen konsign as pesin take dey piss and how pesin go take know if dis sikness dey bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we do as God tork we go see beta blessing and miracle for hawa life...more29minPlay
July 23, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe kain boyfren and girlfren wen today pikin dem dey do wen dem no sorpose do naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God redi to save evry pesin wen come mit am and e no go drive dem commot for bodi...more29minPlay
July 22, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe kain way wen papa and mama go take train deir pikin wen de pikin go take bi beta pikin naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say wen we come mit Jesus e go change hawa life like e change Rahab life wen e no take bi ashawo again....more29minPlay
July 21, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na for God to put hand for moni mata for hawa kontree make Govament pay pipo wen dey work beta moni.De message of Hope dey tell us say as we dey forlow God waka, we go see say God na good God....more29minPlay
July 20, 2024Praise - God word wen we dey take growToday fess song na praya make God hold hawa hand make we fit enta heaven and de sekond song say make we no look back as we dey forlow Jesus waka.De message of Hope say de waka we dey forlow Jesus waka so naim bi de waka wen we go take go heaven....more29minPlay
July 19, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growDe lesin wen konsign as God take tork say de husband naim bi oga kpata-kpata and watin dat one mean naim bi today mata.Today message of Hope say as we dey forlow Jesus waka make we no let fear enta hawa life bikos God no dey give hin pipo fear....more29minPlay
July 18, 2024Family mata - God word wen we dey take growSome small small advise wen wife dem go take make deir marrage stand gidigba naim bi today mata.De message of Hope dey tell us say make we dey take God word take do hawa praya so dat God go dey ansa hawa praya shap-shap....more29minPlay
July 17, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kouf wen doktor dey call tubakolorsis, watin dey cos am and how we go take know if we get am naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say God want make we dey ans am for de tin dem wen we want make e do for we....more29minPlay
July 16, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe lesin today na say make we no dey do dis lie-lie play-play wayo wen pipo dey do bikos pesin fit just die.Today message of Hope dey tell us say de good wen we dey do for even pipo wen no bi hawa friend na one tin wen de show say we bi beta kristian....more29minPlay
July 15, 2024Family mata - God word wen we dey take growAnoda work wen God give man as husband na say naim go dey put moni for ground wen hin wife go take dey manage de family.Today message of Hope dey tell us say as we dey forlow Jesus waka, God grace dey yanfu-yanfu to take commot us from sin...more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,411 episodes available.