Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.
June 15, 2024Praise - God word wen we dey take growToday two song dey tell us say God Law naim bi de life wen we get and naim go fit protect us from de wahala wen dey come for front.De message of Hope say devo go try deceive pipo but if we know God word and do watin God tork devo no go fit deceive we....more29minPlay
June 14, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growE good make woman trust hinsef bicos na as e take trust hinsef na so odar pipo go fit take trust am.Today message of Hope say God know watin we fit do and watin we no fit do and e no go let us get wahala wen big pass we....more29minPlay
June 12, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growLapa-lapa na sikness wen no dey kwik commot for pesin bodi so e go good make we do watin we go do make e for no enta bodi.Today message of Hope say e no mata how bad pipo plenty reach for church, God still get hin own pipo....more29minPlay
June 11, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe wayo wen pikin dem de do so dat dem go pass deir exam no bi beta tin bicos wayo na sin.Today message of Hope na say God tork say pipo fit dey do like say dem bi kristian but God no know dem so make we no bi like dos pipo....more29minPlay
June 10, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe aria for marrage wen husband and wife go for join bodi togeda and how dem go take join bodi naim bi today mata.Today message of Hope na de message wen God give de church wen dey Sardis wen don die but den dey do like say dem bi church wen get life....more29minPlay
June 09, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na for hawa farma dem and watin dem plant make God let dem get beta harvest wen melu, inset, water and odar bad tin no go scata.De message of Hope say make we no dey wey pipo go dey make us sin bicos Jesus go soon come with hin repot card....more29minPlay
June 08, 2024Praise - God word wen we dey take growToday fess song say hawa God dey gidigba, e neva die and e no go fit die and de sekond song say God name get beta pawa.De message of Hope say God pawa for hawa life go epp us get strong mind wen we go take do de tins wen no go let us dey sik....more29minPlay
June 07, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growWatin trust bi for hawa life, how we take dey know trust and de kain pesin we sorpose trust and watin trust for God bi naim bi today mata.Today message of Hope say wen Holy Spirit pawa enta hawa life, we no go dey take sin dey baff again....more29minPlay
June 06, 2024Family mata - God word wen we dey take growTiree tins wen konsign how husband no go work so tay e come forget hin family naim bi today mataDe mesage of Hope dey tell us say God pawa wen dey hawa life dey give us peace even wen wahala dey....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.