Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.
March 27, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe tin wen we go see for hawa mout and hawa bodi wen we go take know say sikness don enta hawa mout naim bi today mata.Today message of Hope say wen God give us in new life we go change and all de bad bad tin wen we dey do bifor, we no go do dem again....more29minPlay
March 26, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe tin wen dey happun hinside hawa pikin dem bodi as dem dey big wen dem dey take know watin man and woman fit do naim bi today mata.Today message of Hope na de call wen God dey call pipo wen wan get de new life wen God dey give make dem come mit God....more29minPlay
March 25, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe kain sikness wen no get kiour wen bitaness, dat vexnation wen dey dey pesin hat fit cos for pesin bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say we sorpose know God if we tru-tru wan get de new life wen God dey give hin pipo...more29minPlay
March 24, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na for all hawa man wen bi husband, papa, broda, pikin, make God for put hand for deir life make deir life for beta.De message of Hope dey tell us say if we go get de beta life wen God dey give hin pipo, we must know God by hawasef....more29minPlay
March 23, 2024Praise - God word wen we dey take growToday song dem de enkorage all of us say God neva forget we and enihow ebi, God still dey for hawa korna.De message of Hope dey tell us say make we no dey worry bicos God dey hawa side and bicos God dey hawa side, no shakin....more29minPlay
March 22, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growHow we go take baff hawa bodi make we no for smell and de ariya dem wen we sorpose wash well well naim we tork today.De message of Hope dey tell us watin and watin we go do as we dey forlow God waka wen hawa fait go take grow come bi big fait....more29minPlay
March 21, 2024Family mata - God word wen we dey take growGirl pikin wem hin mama no train well and bad husband naim dey make some woman bi bad wife.De message of Hope dey tell us say pesin wen no baptise no fit tork say hin bi kristian bicos Jesus say we usto belive and baptise bifor we fit bi kristian....more29minPlay
March 20, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe diffren diffren sikness wen fit happun for hawa mout and watin dey make pipo get dis sikness dem naim bi today tork.Today message of Hope dey tell us why we sorpose go shurch as God pikin bicos Jesus wen bi hawa exampo go shurch well-well....more29minPlay
March 19, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growWatin pipo go do wen we go take end aproko work for skool and family naim bi today advise.Today message of Hope dey tell us watin we go do wen we go take bi beta korret kristian for God eye and for pipo eye....more29minPlay
March 18, 2024Family mata - God word wen we dey take growDe way wen de bitaness take dey commot for one pesin bodi dey enta anoda pesin bodi naim bi today mata.Today message of Hope dey tell us say na Jesus naim bi hawa salvashion bicos na bicos e die for we we go fit enta heaven...more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.