Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.
February 16, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growPriscillia wen bi Aquila wife and how e take forlow hin husband do God work naim bi today lesin.Today message of Hope say as God pipo wen dey wait for Jesus, make we dey do good tin and epp pipo wen we meet....more29minPlay
February 15, 2024Family mata - God word wen we dey take growAnoda tin wen we go take know wife bi say wife go join bodi with hin husband and dem go get one mind dey do togeda.Today message of Hope say as we dey wait for Jesus make we get strong mind for God wen notin go fit shake and hold God kakaraka....more29minPlay
February 14, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growDe kain wahala wen scabies sikness fit give pesin, watin we go do wen we no go take get dis sikness and how we go take treat am naim bi today mata.Today message of Hope say make we pray as Jesus say make we pray make God for ansa hawa praya shap-shap....more29minPlay
February 13, 2024Pikin dem mata - God word wen we dey take growDe kain vex wen dey bring do-mi-I-do-you wen fit wound pesin naim bi today mata.Today message of Hope say anoda tin wen go make hawa fait stand gidigba as we dey wait for Jesus bi say we go dey fast as God say make we fast....more29minPlay
February 12, 2024Family mata - God word wen we dey take growSikness no bi sometin wen pipo sorpose hide for family bicos wen pipo hide sikness watin bad pass de sikness fit happun for de family.Today message of Hope say make we dey wait for God time bicos wen we wait for God, e dey give us hin korret blessing....more29minPlay
February 11, 2024Praya - God word wen we dey take growToday praya na for de pipo wen wound for de Ibadan exploshun, de family wen deir pipo die and de govment for Oyo state.De message of Hope say as we dey wait for Jesus make hawa eye no dey for propati wen we wan gada but make hawa eye dey for Jesus....more29minPlay
February 10, 2024Praise - God word wen we dey take growToday two song dey tell us say wen we forlow Jesus, God go make us new pipo and we go get happiness.De message of Hope say as we leave evrytin forlow Jesus, god go give us plenti blessing yanfu-yanfu for here plus life wen no dey finish....more29minPlay
February 09, 2024Woman dem mata - God word wen we dey take growDe fait wen de woman wen blood dey commot for hin bodi for 12 years. wen torsh Jesus dress, e come well naim bi today lesin.Today message of Hope say wen we bi beta kristian dey waka as God say make we waka, wen Jesus come, heaven go bi hawa house....more29minPlay
February 08, 2024Family mata - God word wen we dey take growBeta wife na wife wen dey make hin husband happi and de happiness dey make deir house bi beta place for pipo.Today message of Hope say pesin wen give Jesus hin life and commot hand for sin na pesin wen Jesus go save and carri go heaven wen e come again....more29minPlay
February 07, 2024Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growOne sikness wen dey dey pesin bodi and e dey make bodi scratch pesin wen doktor dey call scabies naim bi today mata.Today message of Hope say beta kristian na pesin wen dey hear watin God tork and e dey do watin e hear....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,412 episodes available.