Sign up to save your podcastsEmail addressPasswordRegisterOrContinue with GoogleAlready have an account? Log in here.
De program na de ogbonge program wen dey ginger hope for the life of de pipo wen dey hear am evryday... more
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.
October 09, 2023Family mata - God word wen we dey take growToday story na de story of husband wen maray hin wife pikin, give am belle, bon and hin wife no know.De message of Hope say wen life take wahala take stone we, make we get fait like blind Bartimaeus, call Jesus and e go save us....more29minPlay
October 08, 2023Praya - God word wen we dey take growToday praya na for God to commot hawa pikin dem from dis man maray man and woman maray woman wahala.De message of Hope dey tell us say wen we get wahala and ebi like say God don forget we, make we get fait and know say God redi to come epp we....more29minPlay
October 07, 2023Praise - God word wen we dey take growToday fess song say Jesus dey come and de sekond song say now wen life get as e bi naim we need Jesus pass.De message of Hope dey tell us say God no dey forget hin pipo and hinside de wahala we we dey as we call am e go dey deer....more29minPlay
October 06, 2023Woman dem mata - God word wen we dey take growDe woman for today story teach us say wen we get fait and put hawa mind for watin we dey ask God to do for we, God go do am.Today message of Hope say de only pipo wen go fit stand wen tomoro wahala come na de pipo wen dey do watin God tork for hin Word....more29minPlay
October 04, 2023Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take growFruit na sometin wen dey make hawa bodi balance and strong kakaraka so make we dey plan to chop fruit as we dey plan to chop food.De message of Hope dey tell us say make we dey pray and dey shine hawa eye so dat we no go fall hinside temtashion....more29minPlay
October 03, 2023Pikin dem mata - God word wen we dey take growNo pesin dey dis world wen no get friend but de beta rizin wen sorpose make pesin get friend naim bi today mata.Today message of Hope tell us say if we tru-tru say God na numba one for hawa life, we go dey do watin konsign God fess for hawa life....more29minPlay
October 02, 2023Family mata - God word wen we dey take growToday lesin na say make wife wen get moni no take hin husband do boyi-boyi bicos de man fit vex do dem bad tin.De message of Hope dey tell us say wen we do watin God commandment numba 1 go reach 4 tork, naim bi say we dey put God fess....more29minPlay
October 01, 2023Praya - God word wen we dey take growToday praya na for all de pipo wen bad doktor don take wayo commot deir intestines and kidney, make God heal dem.De message of Hope dey tell us say make we put God fess for hawa life and for evrytin wen we dey do....more29minPlay
September 30, 2023Praise - God word wen we dey take growToday fess song na "Ancient Words" and de sekond song na "As de Deer"De message of Hope dey tell us say de korret beta fasting wen we sorpose do na de one wen we go take pray so dat God go epp us commot hand from sin....more29minPlay
FAQs about AWR- Voice wen dey ginger Hope:How many episodes does AWR- Voice wen dey ginger Hope have?The podcast currently has 2,413 episodes available.